August 1, 2025

Kunle JJC: Madam Police (Chapter 6) [18+]

Home » Kunle JJC: Madam Police (Chapter 6) [18+]

Kunle JJC: Madam Police (Chapter 6) [18+]

Deolu here…

Important announcement tomorrow. Stay tuned, some people will not like it, but be here tomorrow

_________

Make I no lie, as Aisha dey tell me the story go my pant done over wet inside my uniform trousers. When she tell me say her D.P.O come catch them, the thing pain me o like say na me them dey fuck. But, I dey gbadun that story eh.

Why D.P.O. go enter that kind time na. If this thing fit pain me wey dey hear the story like this, how the thing go take pain Aisha wey dey collect penis and those guys. I begin ask Aisha say wetin come happen after that one.

She tell me say oga dey there dey point them gun o, she come wear her trouser dey come outside with the chair wey she carry enter the cell. The boys dey there with their penis, everybody dey look as D.P.O dey rake for Aisha, dey vex say Aisha no get shame, she no get level, na criminals dey come knack am inside cell as she fine reach.

Me self begin reason am o because this Aisha girl na spec she be. Why she go carry herself enter cell dey fuck criminals o? But, the two days wey I done spend with Aisha done make me sabi her behavior small. The girl no too get problem like that. Once konji hold am, na anybody wey dey available for am she go chop o.

Aisha talk say as she comot finish, D.P.O. tell am say make she come him office when she return the chair finish. As she enter him office, the man still dey vex but Aisha sabi wetin dey pain am ganagan.

Na because say him been done dey eye Aisha kpekus since and she never give am chop and he come catch her dey carry the thing give three people at once.

Aisha enter, the man begin gas again dey shout for her head. She say she no even dey hear am o because that konji still dey for her body. She just comot go where him seat dey come begin whisper for him ear say them just start to fuck when him come scatter their parole.

She tell am say the konji still dey hold am o and she no sabi whether oga D.P.O go like finish the boys them just start. As she talk am finish, Oga D.P.O just enter mute. Be like him self dey reason the matter. Aisha no give am chance to reject the offer, she done shift go back begin comot button of her uniform make the man for see her breasts, she kuku done comot her bra since.

As the man begin see breasts, be like him brain lost. He just siddon dey look like mumu. He dey look Aisha breast dey lick lip before him eye begin go her trouser dey look her kpekus side.

Aisha come close the man again come tell am say if him no wan fuck her kpekus because say him done catch person wey dey fuck am before, say him fit fuck am for yansh o.

As I hear that one, me self shock. Yansh ke? AISHA dey collect prick for yansh? Omo, which kind girl be this o. She say as D.P.O. hear that one, he just stand up begin unbuckle him belt before she rush go meet am again tell am make he calm down.

She tell am say other officers go soon begin resume o and she no go like make anybody spoil her cruise again. She still tell the man say after him done dey eye her kpekus all these days na quickie him wan do or he no go like make them find one better place enjoy themselves wella. She tell am say make them go rent hotel or make the man carry am go him house.

Na for here I give up on Aisha o. Make married man carry you go him house go fuck. You no even send him wife and pikin. The man rush buckle him belt as Aisha self begin button her trouser. As them pass counter, patrol van enter station.

Him give Aisha key say make she go wait inside him car. Him come go meet the other other officers begin follow them talk. Aisha carry water from her bag, she bend down for beside D.P.O. car come begin wash her toto.

As she enter car, she push her trouser go down small make her toto dey collect breeze. Oga D.P.O. just enter car, he no even fit complain say why Aisha comot trouser. As he begin drive, Aisha carry one of him hand come her toto. He dey use one hand play with toto dey use the other one for steering. Aisha dey there dey moan dey use one eye gauge him penis for trouser. As them enter express, he carry hand comot for her toto come begin press her bress. Aisha self dey enjoy as D.P.O no dey dull the matter.

But she been wan see him penis make she sabi wetin she wan go collect for where she dey go make he no be say na small thing. She begin dey unbuckle D.P.O trouser o, the man begin ask mumu question say wetin Aisha dey do like say him no sabi.

Aisha kuku no answer am until she carry him penis comot o. she say if to say this man done show am him penis since she for just dey dash am free kpekus without billing self because that penis na the kind wey she dey like. He long, he fat, he still come carry veins join body. She no even care say the man dey drive for expressway before she carry her mouth cover ontop the penis.

Omo, D.P.O drive go slow lane begin drive for there jeje as Aisha begin suck him prick. He just dey hiss and small time he go hold Aisha for head. Aisha sabi say she dey scatter him medulla. Small time she hear say gate dey open and the car come begin dey stop.

D.P.O tell Aisha say she them done reach hotel o. Aisha release him penis, the man self sigh, him body self come down small. Aisha look around small, everywhere dark. She begin push her trouser go down wella turn yansh go D.P.O side. The man dey ask Aisha say wetin dey sup.

Aisha just tell am say make them do small inside the car. Before the man go fit talk anything self, she done hold am for penis begin shook am inside her toto. He just sigh as him penis begin Aisha toto. She no let the man hustle, na she begin ride am by herself. As the thing dey go, the car begin shake.

Oga D.P.O self no waste time, he shook hand inside Aisha uniform hold her two breasts begin press am. He done tey wey him wan do this thing and he just dey sweet am until penis begin knock him side window. Aisha begin hiss. She wind the window down shout ontop the security man wey come knock the side window head.

She comot from the car come begin wear her trouser back. Oga D.P.O wear him own trouser from inside car. Them enter reception go collect key come go their room. As them enter, Aisha just comot her full uniform dey there naked.

She enter bathroom put water for body before she come back meet D.P.O.  Him self done naked dey wait make Aisha show face. Aisha look the man dey look him penis. She done plan say she go too enjoy herself. She go inside her bag comot handcuff carry am come meet D.P.O.

The man first confuse. Aisha tell am say make him handcuff her hand for her back come begin fuck am anyhow wey him like say na wetin she want be that. Ha, I shock again o, this girl really dey craze.

She say the man handcuff am o come enter her toto for back begin knack am, he dey use him penis comot all the shakara wey she done carry am do all these days comot her body.

She say as the penis do mistake comot for her toto self, she bin wan complain but oga D.P. O no even waste time, he just push am inside her yansh.

She say na that one sweet am pass because he be like he dey touch everywhere for her body. Her legs them begin shake, D.P.O dey push the penis go inside her yansh na him she fall inside bed o. The man reposition himself begin knack am like that.

She no even fit moan outside because her face dey inside bed and she no even fit push D.P.O comot because he done lock her hand. Me wey dey hear the story, I done over wet so tey if I comot my pant like this and I squeeze am, the water fit full bucket self.

As Aisha wan continue this story naso one thin tall hausa Alhaji enter station come meet us for counter. Him begin ask us whether D.P.O dey around. Aisha begin use Hausa language answer am. Chai, this girl na ashawo. He sure me say as she done see this Alhaji, she done like am and na why she dey follow am speak Hausa.

Small time two of them look my side, the Alhaji come smile. I dey look two of them like mumu. Wetin funny? And wetin be Nunu wey wey them dey talk about. Na so Aisha carry hand come my chest. I first think say she wan dey press my bress for visitor front before I come realize say na my front button done open since and na Aisha go cause am o that time wey she dey follow me play.

As the man comot, Aisha look me come begin whisper say I done use my breast catch Alhaji o say whether I go like fuck am.

Written by Reezy Sama

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

Norway/NetherlandsFill Norway/Netherlands Form

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 3974 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics