As we enter inside my apartment, Maureen nearly use wow kill me, she just dey call me big boy say I dey chop life.
Normally, my apartment set well and I furnish am with expensive modern electronic gadgets, you go think say I wan live there forever. Na why I no dey gree make all this girls come my place because I know say dem go like glue for my side. Maureen first enter toilet ease herself, before she enter kitchen begin cook.
I just dey look her as she serious dey cook, for my mind I fit bet am say this lady never cook for her BF like this before. I leave her enter room dey press phone. Na only when she need something wey she want make I tell her where e dey or when she need my help with something she go call me from kitchen I go waka go meet her.
But all that time I don know say everything go end for fuck, I just dey wait make she cook finish, make we chop before I go chop her. for my mind I say kai see me wey start my service year with goal of celibacy, now I no know if na country I dey serve or na my penis I dey service.
E get as the aroma of the soup wey Maureen dey cook scent full everywhere wey I just get up waka enter kitchen, see as Maureen serious dey cook like new wife wey dem marry new.
I first whine her small, say the aroma no gree me rest, she laugh. I waka go her back, wrap my hand for her waist hold her from behind, I cup her small breast through the polo wey she wear begin squeeze her nipple gently, she rest her head for my neck come dey turn her head left and right.
She tell me say make I wait say she go soon finish, but omo my body no fit wait.
I press my hard cock for her nyansh make she feel my erection well, na then me sef I notice say I no feel any obstruction. E dawn on me say that time wey she enter toilet as we come back from market, e be like say na then she comot the bumshort wey she wear. With this revelation, I fold her polo up immediately.
My body no fit contain my excitement as I carry hand grab her bare nyansh, Maureen moan one kind soft sexy moan. By then she don already drop the spoon inside the soup pot wey dey boil for our front. She put one hand for the kitchen cabinet, push her weight for her hand so that she go fit press her bare ass well against my erection.
She begin use her second hand pull my short knicker down, my penis spring ready for action, as she free am from my knicker.
Sharp sharp, I arrange her well for the cabinet, I lick my palms, wet am with enough saliva take am rub my penis, i use my penis tap her pussy opening small, she shiver, before I push am straight inside her. I begin fire her immediately, dey pump her toto from behind.
If to say I no fuck her I no go know say Maureen na number one town crier, small quickie wey we start inside kitchen, she begin shout full the whole house. Akwa Ibom girl wey dey use her native dialect dey praise me as I dey fire her. Her toto wet like osun river and e wide kpa, like say trailer don pass there before.
If not for say I get big preek only God know wetin dem for use drag me out from her hole.
Me wey Conji don show me shege that afternoon, I just dey drive in and out of her toto with brute force wey make Maureen just dey shout “yes fuck me…… yes fuck me…… yes yes fuck me” sometimes she go make sound like say she dey cry, sometimes she go change am like say something dey choke her for neck. The fuck sweet her sotey she raise one leg up hang am ontop the cabinet…… I say shuuu.
na that time my preek enter deep inside wey she make one loud sound like motor wey fail brake. Me I no just give her space, afterall, na wetin I bin call her for be this, the whole idea of cooking na just camouflage.
Na then e dawn on us say wetin dey smell no be our fuck, na the soup dey burn!
“jeeezzzzz” Maureen shout as she pull her body away from me, push me comot quickly, she switch off the gas, both of us burst laugh, dey laugh ourself how we nearly burn a whole pot of soup because say we dey fuck.
After we eat finish, we bath together, na from bathroom we begin fuck till we climb bed, na there I pound her toto finish. i fuck Maureen like say I wan harvest her pussy comot from her body. She sef use noise shake the foundation of the house.
If to say na only the noise she dey make e for better, wetin off me pass na how she dey hype my performance inside the whole noise. Person wey dey outside wey hear wetin she dey talk sef go dey want my preek.
I know say Aunty Kate sef go dey hear Maureen noise, she go dey talk say make corper no go kill person for her house o!
After two long rounds, Maureen agree say she go sleep over for my place that night but she say she go like go her lodge first go tidy up somethings.
Na around 7pm, when we don use fuck scatter ourselves, I drive Maureen go her corper’s lodge. I wait for her outside make she warm her food then pick her night things and cloth wey she go wear go her PPA the following day.
I no go even call that one sleep over because we no even sleep throughout the night. Na fuck over we do. We knack throughout the whole night like say sex na protein.
Omo, Maureen like fuck die and she dey very active. no be say her pussy too set like that, she dey very wide and na water water pussy she get, small thing she don over wet.
But wetin I like for Maureen na say she sabi fuck man well, after all she no be small pikin, person wey fit don near thirty. That girl endurance and energy na over hundred.
She no follow for those ones wey go just lie down dey expect make you do all the work, Maureen dey finish work. She fuck me sotey na me even come dey tire. Anytime she notice say I no dey go hard again, she go take lead role begin fuck me, make I dey use am gather energy back.
E no get position wey she no sabi do, naso she just dey bend body like rubber, dey twist like wire.
Even her blowjob na one in town, she suck my dick with one kind expertise wey mesef fear say Skirt don jam Trouser! E get when she ask me if I go give her head? Me wey I suppose write toto licking as one of my skills for my CV, I lie tell her say I never lick toto before for my life. Maureen say eyah say she go teach me how to do am one day.
Maureen comot mind ride my preek, give me one kind confirm reverse cowgirl, aswear na me come dey moan dey say “wow wow….sweet jeezz….fuck” she take pussy grinding mesmerize my penis, and she sabi whine well well. Small time she go switch, begin bounce ontop my dick like say spring dey under nyansh.
My own na to just take my hand hold her nyansh dey control her rise and fall make she no go fall my tool. The way Maureen take knack me that night you go know say the girl na old timer. E don tey wey she don dey handle penis just like Essy too, but her game pass Essy own by far.
Na as I dey go school the following day I drop Maureen off for her PPA, then I run her 20k say make she take am buy lunch and I tell her say make she feel free to call me anytime wey she wan come around. Deep down inside me I know say as I don start to dey knack corp member naso I go dey fuck all of them one by one.
As I dey hope for weekend to reach so that I go fit run Debby matter, naso I still dey pipe Essy almost every afternoon, if I come back from school, that one be like daily routine wey I no dey miss.
E come be like say that week Jummy and Debby plan am for me, as I still dey wait for weekend to reach make I go play away match for Debby house, na eim Jummy apply serious pressure for her gum body dey follow me everywhere like say Debby send her make she come complete our fuck.
Na her follow follow wey make me fuck her inside toilet for school one afternoon.
That day I no even carry am for mind say I go fuck her. The utility staff tell us that morning say the male staff urinary get problem, say make everybody use the female staff urinary. The female urinary dey two, so dem convert one to male urinary just for that day.
As school dismiss I enter the female urinary wey dem convert to male urinary say make I piss, before I begin dey go house.
I never even piss reach half when person knock the door. I quickly talk say I dey inside. but I notice say the person still turn the handle try to open the door even after I don shout am talk say I dey inside, thank God say I bolt the door as I enter.
Aswear I think say na the cleaner because that woman too dey do mumu sometimes. As I piss finish I notice say the person still dey there dey turn the handle dey try open the door.
Na eim i use vex pull the bolt open the door, na Jummy I see! She just stand there dey smile one kind nonsense smile. She look me from head go down, come set eyes for my trouser zipper.
Na then I notice say I never even fasten my zip, I quickly turn small as I wan zip up, Jummy hold my hand like say she dey stop me from zipping up, she push me enter inside the toilet, come use her other hand close the door, bolt am again.
She whisper tell me say she bin wan join me as I dey piss but I no gree open the door for her, say now wey she don enter make I begin piss again or make I do my worst. Na her big breasts my eyes first fall on before I look down see say with the kind short skirt she wear e no go hard me to do my worst.
I come laugh, I tell her say if I do my worse make she no complain o. she laugh say oya na say make I do wetin dey my mind. I no even allow her finish wetin she wan talk I take hand grab her big breasts.
I begin fondle am aggressively, her blouse thick well but I still feel the softness of her bress. She quickly open her button comot her top hang am for one corner of the toilet, me I quickly unsnap her bra hook, her large breasts wobble out, Maureen bress big no me here, come occupy her whole chest.
I first target her nipple squeeze am gently. She begin dey cross her leg dey do like say something dey sweet her in-between her legs. I know say we no get time as anybody fit come use the toilet.
I unhook her skirt, fold am up quickly make I work on her, but I notice say she wear tight, the thing weak me, I no dey like make woman wear tight because e dey always delay my movement.
As I chook my fingers inside the band of the tight to pull am down. Jummy hold my hand tell me say make we no do am inside there, the kind way I take squeeze one of her nipple she nearly scream. No be me she go suffer with conji again like Debby take do that day.
I unfasten my belt, pull my trouser down with my underpant make I know weda she go still dey do smeh smeh when she see erect penis. Jummy carry hand hold my stiff penis, she sef confirm say I don dey too hard to dull.
She look down look my penis come smile. She whisper again, tell me say my preek big and long and say she like am like that. As she hold my preek dey stroke am, I dive my face go her neck dey kiss her neck and ear still dey squeeze her nipple.
I use my free hand try to comot her tight again, this time she no protest am, she even join me help me join hand pull her tight down, as the tight reach her thighs, I slip one finger take am shift her pant one side.
As I dey shift her pant my fingers stray touch her pussy, Maureen don already wet. She raise one leg up set am for the toilet seat, that position she stay give me enough chance to push two fingers inside her toto, as I slide my fingers inside dey tickle inside her wet cunt, naso she begin drag her pant down with force.
As she bend down to slide her pant off her leg she stop again look my preek, then she use her finger clean the pre-cum wey dey the tip of my cock, Jummy raise her head up look me, me I look her down, na only me fit describe wetin I see for her eyes that moment.
Jummy first use saliva wet her hand very well before she grab my cock, my whole body shiver. She use her tongue tease the tip of my penis, the thing sweet me ehnn, I fold her braid, hold am tight.
She take her tongue lick my penis go down to my balls, still even go down lick my thighs down to my knee. The way my entire body bin dey shake like tiger generator, for my mind I say shuuu dem dey lick kneecap join for foreplay?
Jummy lick me back up, then she focus on my penis, use her tongue lick round my dick cap before she swallow almost my whole penis one time inside her big mouth, begin suck me like say dem put gun for her head say if she no suck me well dem go shoot am.
I just dey look her as she dey drag her head front and back, dey suck from the cap of my penis to the end, even as my big cock dey make her choke, dey make funny sounds, Jummy no stop, she even they stroke am as she dey suck me with speed. My whole body bin dey do me like say I wan erupt.
Who go ever think say she go sabi give head like this, the thing sweet me enter my brain… until we hear the door of the second toilet as e open, person enter inside. Both of us freeze.
Written by D.N.D
If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below
Norway/Netherlands – Fill Norway/Netherlands Form
Canada – Fill Canadian Form
United Kingdom – Fill UK Form
United States – Fill U.S Form
Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world
This post has already been read 722 times!