I don do this Yahoo thing for years, e no get site wey I never bomb to find client. Aswear even Taliban and ISIS no bomb reach me. I do sotey I even do local, enter my church whatsapp group dey find person wey I go scope. Upon say I dey work as supervisor for one furniture showroom, I still dey browse steady, I just get hope say one day I go cash out big.
Wetin surprise me na the wey my guys wey all of us dey run the same update dey pick money anyhow, I come dey think say abi person don already use me collect my star, because even common paper I no see to pick.
One of my guy wey dey cash out well well say make I go run yahoo plus, say na wetin eim do. Omo me I no gree at first, nothing the guy no talk to convince me wey I gree listen. He say na to just go clean my path, I say NOOO!
The guy say where eim go carry me go I no go kill anybody or do anything harmful, say dem go just wash my head so that I go dey see better client wey go dey pay me better money. I say Taaaaa! Me I no go put my hand for any juju thing.
Na when my babe Bose, leave me go follow one big boy like that for town, na then my eyes clear. Bose come visit me one afternoon wey I dey wash cloth for backyard. I first no do like say I really notice her because me and her bin don dey get small issue then, I notice say she come dey form over busy for me everytime.
My mind tell me say she don dey cheat but I die the thought because normally I dey do Bose well. Bose like fuck scatter, if to say dem dey dash money for every fuck wey we dey fuck, me and Bose suppose don rich pass Elon Musk. Sometimes I dey reason say the grace wey I for use get money e come be like say na eim I switch am get stamina and endurance for fuck.
Na she carry herself later come meet me for backyard, when she say see I no even do like say person find me come, she come begin dey beg me say she bin dey very busy, say customer full her shop. She talk plenty things sha before I come give her face enter house with her. na as I enter I see say she even carry food come, better semo with egusi soup with enough meat, I say toor…….
After we chop finish that afternoon I tell her say I wan go continue dey wash the cloth wey I bin dey wash, Bose just pull my hand drag me with her go ontop bed, i no even give her space, we comot cloth with one kind speed, I no even check if her pussy wet or dry, I just spread her legs open, drive my penis wey don already hard like steel inside her pussy.
Na as I enter I notice say she sef don even wet, naturally Bose dey everly wet for me. E get as her pussy hot come dey scent different, wey my mind tell me say this thing no be as I leave am last but omo I no get time to dey reason, I just dey enter in and out with top speed, dey fire her toto with vex say she no give me toto fuck for weeks. Na after the first round wey hot and rough like war, I come calm down begin kiss her, touch her body, suck her bress.
Then I turn her make she dey on all four, raise her nyansh up, grab her butt cheeks, separate am wide with my hand, come chop her toto from behind like say na the second food she carry come. I make sure say I chop her pussy until she cry that afternoon, I use my tongue dig her pussy, suck her clitoris, tease her whole toto till she begin jam her pussy for my face dey face fuck me. After that one, I give her one kind doggy wey she use noise nearly throw down the whole compound. From Doggy we enter missionary again, as I dey fuck her naso I dey imagine say person too dey fuck her and na that vex I use knack wetin no good for her body.
Bose no understand wetin dey play for my head, she just dey jump from one end of the bed to another end dey change position for me, me I just dey wipe her penis.
By the time we finish, if you see as I weak like say I go serve mason for site. Na later that night after she don go she send me one kind long breakup message like that say she no fit continue with me, say she get needs and me I still dey struggle to fix my life, say make I just move on. I nearly run mad that night as I read the message finish. So all that fuck na “vote of thanks”.
That period I no get myself, na that time I tear eyes say I go do the washing and setting, before poverty go make me lose my future wife. I bin no wan go the native doctor wey my guy tell me about because I no too trust all these guys, before person go use me get the money wey I dey find. Na one okada man I ask if eim sabi any strong native doctor.
The bike man say eim go carry me go meet one woman for eim village, say she dey use 200k work better jazz for boys, say eim don carry boys go there well. Fast fast I sell my laptop, sell my second phone, borrow money from my mama, join am with my savings, everything i raise na 350k because the bike man sef charge me 20k to carry me go the place.
Naso we set out one Saturday afternoon, omo the place far die, wey me sef i begin get doubt dey fear weda the bike man no dey carry me to go sell me. Finally we reach one kind typical village like that, wetin first off me na when I look my phone see say all that area no even get mobile phone network.
As we reach the village, we still dey go inside through bush like say we dey find evil forest, remain small I bin wan ask the bike man to stop until we reach one compound like that. Fear don already hold me finish, but na only me know wetin give me the kind boldness wey I carry that day.
The house na one old jagajaga bungalow for one bushy area like that. As we enter the compound, one fine girl meet us outside, she tie white wrapper, dem no need tell me say she be shrine attendant, the girl fine well well, get better shape with confirm ass and bress, e sure me say, she go be all this ogbanje mamiwater.
As we dey follow the girl, I take eyes scan the compound, just trees and farm, dem tie red rope for almost all the trees. The girl carry us go the backyard where the main shrine dey. I see juju things cold enter my body, the whole courage wey I carry from house vanish one time, remain small I shout blood of jesus for juju house.
Doll baby just hang everywhere, with fowl feather and red cloth, exactly as I dey see am for film. E get clay pot wey smoke dey comot from, but the pot no dey ontop fire. Na as i till dey scan the whole place I come sight the big fat woman wey sit down for one corner of the shrine ontop one small stool dey cut one kind leaf.
The woman fatness no be here, and she sef tie white wrapper too, na the stool wey carry her whole weight I pity pass. i notice all the beaded chain and cowries wey she pack full body from her head to ankle.
The woman and the bike man greet like people wey sabi each other well well. She tell me say make I sit down for one small stool wey dey her side.
I look the woman body, stretch marks decorate her arms like say na design, I no fit even tell her real complexion because the kind color I see full her body confuse me, the woman fine for face o, she fine well well and as I look her face, she look like person wey never old at all, probably in her late thirties, but she too fat. I begin dey wonder how fine lady go just sign say na wetin she wan take her life do be this.
When she finish with the leaf, she call the girl “Timilehin” make she come carry the tray comot. I take time look the girl again, The girl sef no bad at all, see fat big nyansh dey shake recklessly under the wrapper wey she die, e clear say she no wear anything under the wrapper, and I even sight her nipple as e stand pim pim for her chest.
I wonder wetin go make fine girl like her sef agree say na shrine she wan dey unless she be ogbanje. I wonder if she dey fuck sef, because her nyansh no go bad to fuck especially with my kind long penis wey curve like garden sickle.
As the girl carry the tray comot, the woman come face me ask me wetin I want. I tell her say I dey find wealth and success. She laugh one kind laugh, she say she sef dey see greatness ontop my head. Na then she give me one small calabash make I talk wetin I want inside am.
I first fear to collect am but the bike man signal me say make I collect am. I collect the calabash, talk everything wey I want inside am, give the woman back, she cover am, come tell me say na for midnight we go run the sacrifice— Ahh! Midnight! Onto say I go sleep for the shrine! I look the bike man, that one cut eye give me say make I relax.
Later the bike man tell me say eim go come carry me the next day say make I no worry say everything go dey ok. As I dey look the man as he dey ride eim bike dey go I say heeiiii wetin I don go put myself inside. I don hear stories of how guys dey sleep inside coffin and for cemetery say dem dey find money.
Who go know say one day me sef go sleep for shrine, a whole me Demola, pikin of prayer warrior!
The woman say make I give the girl money make she go buy the things she go use for the sacrifice for the village market say everything go cost 30k, I count am fast give the girl still give the woman her 200k, I still give the girl exta money say make she help me buy banana and groundnut if she see for the market.
Na for outside I sit down dey play game for my phone until night reach, that time the girl don come back, both of them dey busy dey pound dey cook for backyard. Later the girl come meet me for front say make I come chop— make I eat mamalawo food for shrine? Abi she dey whine me?
Even though hunger bin dey tidy me then because na only the banana and groundnut the girl bin buy for me from market dey my belle but, I just shake head tell the girl say no say I no dey hungry. She tell me say I go like the vegetable soup, all that time my concentration don shift from her face to her nipples wey point out inside the satin white wrapper she tie.
I smile tell her say make she no worry say I dey ok. As the girl dey go inside I look that her big portable nyansh again, the way her buttocks just dey sway inside the wrapper muse me, so na like this she go that market without bra and pant.
Small time the girl waka come again ask me if I go like baff hot water or normal cold water, baff ke? I tell her say no say I no go bath, she say no, say I go need bath before the ritual. For my mind I say toor, I tell her say make she make the water warm.
As she waka dey go I look her again….. omo this girl go sweet, and the way she just dey shine teeth for me, I say if I fuck this girl she go steal her madam juju dash me… ordinary the way she dey waka dey shake her nyansh I know say, this girl dey intentionally shake her nyansh like that for me, how person go dey waka and nyansh go dey shake like say the person dey dance.
As she reach the end to turn to the backyard she come turn look me again our eyes jam. She wink eyes come waka go. Omo that moment even my penis confirm say wahala don dey..
For my mind I say kai, make this woman just use this girl do me thanks for coming, the kind way I go like fuck her ehnn.
Written by D.N.D
If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below
Norway/Netherlands – Fill Norway/Netherlands Form
Canada – Fill Canadian Form
United Kingdom – Fill UK Form
United States – Fill U.S Form
Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world
This post has already been read 4626 times!