September 4, 2025

Kunle JJC: Madam Police (Chapter 7) [18+]

Home » Kunle JJC: Madam Police (Chapter 7) [18+]

Kunle JJC: Madam Police (Chapter 7) [18+]

Omo with everthing wey I done learn from this girl since she resume work for our station, to when I go her house o to the ones wey she done tell me, no be time to dey dull dey do shy shy be this.

As she ask whether I go like fuck this Alhaji wey just pass our counter eh I just dey nod my head like agama lizard say I go fuck am o. The man clean, he tall come slender, I dey imagine say him penis abi na burantashi as my friend dey call am go long like that too.

He be like who go get better money for hand self and  na that kind parole me been dey find now because all this police work come tire me now. The small thing wey Aisha done show me, tell me and the one wey she done do for my body done show me say I no dey the right profession.

I no suppose dey suffer for penis and money as I been dey suffer na because say I no sabi how to use wetin I get well or because I dey shy self. Na him dey make me suffer. But, Aisha done clear all that one comot now, I just wan chop life now, collect better penis and better money.

At least make I dey as Aisha dey with fine place to stay. I no even waste time, that uniform button wey I been dey lock before, I open am again make this Alhaji for see my nunu well well. Aisha look me open mouth dey ask say wetin I dey do. I just laugh say I want make Alhaji see my nunu na. She burst laugh begin press my breast o before D.P.O. and Alhaji come meet us for counter.

The man ask say which kind rubbish we dey perform. Be like the man no sabi say Alhaji dey eye my nunu. Me and Aisha rush do salute wey make my bress dey bounce ontop my chest. Everywhere first quiet before I look these men o.

Na inside my cleavage their eyes for lost o. I nearly burst laugh for my salute position. As D.P.O. put me and Aisha at ease eh, I make sure say I shake that my fine bress again make D.P.O and Alhaji them see something look small.

Omo, I no even sabi wetin dey do me. I done dey turn bad girl and na all the rubbish wey Aisha dey tell me dey work for my body as me self wan do this bad girl thing small.

As my breasts the, stop to bounce na, D.P.O finally get himself. Baba first clear him throat before him come tell me and Aisha say we go follow Alhaji comot o as orderlies for him wife for one event wey them wan go.

Omo all the happiness wey I dey feel first die o. You sabi na, how we go be orderlies for him wife? No be am dey tell Aisha say he wan fuck me before? But no yawa na. D.P.O. say make we follow Alhaji dey comot immediately.

Aisha look me wink, me self done sabi. No be only orderly work we go do, We must chop this man penis before we come back this station o. That my happiness we die before come begin dey wake back. We follow Alhaji rreach him jeep, omo, very fine ride.

Him even open door for us. Na that one first surprise me. Rich man dey open door for orderly ke? As Aisha body no dey stay one place na, na she first go front. I see as the man take give am one good spanking for yansh as she dey enter him jeep.

She self dey tell am say “Alhaji, please”. Ha, I first shock but me self go like to level up o, I rush follow Aisha for back make rich man spank me self for yansh na. Omo, the way this man hand take wipe me for yansh come press am hard eh, make I no lie, I feel like olosho wey him order.

He just dey funny me say this man just enter station order two olosho like that. With the way him take grab my yansh eh, he done sure me say me and Aisha go fuck this man after we finish orderly work with him wives dem.

As I enter the ride wey AC knack my body, that my toto wey been dey wey before just begin dey dry up but the konji wey dey hold me no gree clear o.

Alhaji enter jeep with us. I been think say him go just enter siddon for front with driver o but this man enter backseat join me and Aisha. No be only that one self, he make sure say he sidon for our middle. He come face Aisha begin follow am knack correct Hausa. Me I no wan dull am o, as them dey talk dey go, my hand just dey rub Alhaji for thigh as I dey watch him bura begin dey show face o.

Omo Aisha no lie when she tell me say Hausa people been ges oet penis for hand because this thing nearly long reach this man knees o. And for wetin me I dey see so, my toto just begin dey jolificate. I dey use style style rub Alhaji burantashi from inside him Sokoto dey make the man force hiss as he dey follow Aisha talk go.

As them finish them talk, I been dey expect say Aisha go translate everything wey she and Alhaji done discuss for me o but she just comot the man cap dey rub am for head. Alhaji look my side come carry my hand  comot for him thigh put am ontop him penis. I first shock,  as he come dey ask me say whether I been dey fear to touch him penis.

Me I just smile o because make we no lie, I been dey fear to touch that him penis because that thing wey done long like anaconda for inside him trouser so? As him put my hand on top am, he be like this penis just dey grow dey go. Him dey smile come ask me say make I unbutton my uniform.

I shock like mad. I first look the window, we dey for inside traffic o. I no sure say my bad girl done reach this level o. Alhaji see as I dey look all the windows like mumu come tell me say make I no worry say him window na tinted glass say people wey dey outside no fit sabi wetin dey happen inside this jeep. Be like him see the doubt for my face.

He just begin untie him kaftan Sokoto. If to say na normal person, him penis for just stand like iroko tree as him comot him Sokoto but this one too long na Alhaji use him hand carry the penis comot for inside Sokoto. I look Aisha eyes, I just dey see joy inside. Be like na wetin she done dey find since be this.

As Alhaji done comot him prick inside this jeep na, me self no fear say people go see us again. I just comot all the button wey been dey hold my uniform make rich man see my bress o. as him see am, hee shout wayo Allah come use hand dey carry my bobby one by one like say him dey check which one heavy pass.

The way him take begin dey press my booby first shock me until him come hold two of them for hand dey squeeze them o. That my toto wey been dey dry before because of AC just begin drip again because this man no just dey weigh my bress o, he dey press them join but the thing wey my eyes dey ontop na that him long penis.

Small time, him no dey press my bress again, him dey suck my nipple. Me I dey pity the driver o and my uniform trouser, because I just dey moan dey shout. “Ha, Alhaji, stop”, but him na sabi man, him no stop o. I dey rub him head go na so my eyes catch Aisha, she done begin suck Alhaji penis as the man dey suck my bress.

As the thing dey sweet me, my eye dey ontop that penis wey Aisha dey suck. Make me self try am get connect like Aisha now.

As she see say I done carry my hand hold Alhaji penis, Aisha just stop to dey suck him penis, she say make I try am too. I just dey happy say Aisha na good friend. I put my mouth ontop the penis o but he big pass me.

I no gree, I make sure say I swallow the bura head dey suck that one go make Alhaji dey suck Aisha breast too. Small time, Aisha comot my head for him penis come begin suck the penis again then Alhaji begin suck my bress again.

As Aisha stop, I think say she go allow me suck Alhaji penis again o. She no gree, she just siddon ontop Alhaji penis, back the man begin dey ride this long penis. Alhaji dey hold one of my bress dey suck the other one, me self no gree dull the moment, I use one hand dey press Aisha bress.

As the thing dey sweet me reach, I no lose focus, I just dey watch as Aisha dey ride that big bura dey see as he dey comot her toto dey enter because me self wan impress Alhaji o. As she stop to dey ride Alhaji like this, me self push am comot make I shine small show Alhaji say me self na sabi girl.

Omo, me self siddon ontop Alhaji bura o but instead make I back am the way Aisha take do, I face Alhaji, I wan make he see these my fine bobby well well. He done reach time wey I go begin use wetin I get correct.

I just kuku off my uniform make Alhaji for see my full body. I even carry him hand take hol my waist come begin ride am. Aisha just dey press my body all over dey spank me for yansh. Alhaji come dey suck my bress.

Body dey sweet me, I look window see people inside traffic but me I dey inside AC dey collect better penis, na the kind life wey I wan dey live now be this. The penis be like wetin too big for my toto o but I still manage dey handle am.

I just dey ride am dey go. I no even send say another person dey jeep with us dey drive the jeep or say na Alhaji house we dey go to meet him wives wey we go do orderly for. I fuck Alhaji penis s tey, him begin suck one nipple, Aisha begin suck another nipple. That one no just fit comot eye for my bobby. I close my eye dey enjoy the thing till I cum o.

When my eyes open, na hotel we enter, no be chief house.

Written by Reezy Sama

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 441 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



All Time Favorites

Verified by ExactMetrics