June 7, 2025

YeyeGist: Agatha’s Playbook (Chapter 5) [18+]

Home » YeyeGist: Agatha’s Playbook (Chapter 5) [18+]

YeyeGist: Agatha’s Playbook (Chapter 5) [18+]

Na one of those phone applications wey dey display caller identity wey make me know say na Charles dey call me, as I see the name, my mind just tell me say na eim because I no sabi any other Charles. The same Charles wey bin dey cry as eim dey fuck me.

Person wey dash me millions for one night knack, guy wey chop my toto like food, who no go fear guy wey lick ashawo toto. one mind tell me say abi the guy wan collect eim money back, maybe that day eim no get himself. As I answer the call, Charles first complain say I no call am since. Na then I let am know say I no even get eim number.

Deep down e sweet me as the guy just dey hala why I no reach out to am all this while. I come explain give am say that last time we meet say na eim collect my number, I no collect eim number and na eim tell me say eim go call me.

Me and Charles talk for long, eim even tell me say make I let am know anytime wey I go dey free say eim go like see me again. Something wey I don dey wait for since, remain small I for shout tell am say I dey free but I just comport myself say make I respect myself. After all me sef I big, I no be small pikin again, Agatha don liberate me from ashawo kobo kobo to proper Olosho.

The money wey Charles give me still dey cool for my account and I still dey make more money steady for the hustle with Amabe goodluck and protection charm wey eim fuck inside me, and as Charles don talk say eim wan see me again e sure me say more money go drop. I don plan my life finish say any money wey drop again like this e go be like say I do blood money because the way I go just take upgrade my life people go think say I go carry okiite or I sell my kidney.

Agatha go say every ashawo get graduation date, nobody wan dey street dey fuck forever, plans and goals full ground but na grace and greed dey control everything. Omo since that day wey I jam Charles and eim give me all that money I confirm am say my toto carry grace and as I come meet Amabe again wey eim run eim own jazz for my body, my clients change instantly, na only big big men dey call me and dem dey drop better money for just small fuck.

E get when I tell Agatha say I go like do surgery make I enhance my nyansh again, make e dey perfect, Agatha advice me say make I no do am o, say if I do am, na money wey I suppose take run other things for my life I go use dey run maintenance for nyansh.

Agatha carry me go mirror for her shop say make I look myself, she blow my head with praises that day ehnn…. Say shey I no see as I set well well, me sef I stand for the large mirror look myself, I look my whole figure say yes…. God finish work for my body.

Normally my nyansh mighty, round, get enough flesh, wey dey make men dey craze, small thing dem don turn me wan fuck from back like say dem fit handle me, infact over 80% of men I don jam no sabi fuck my nyansh, and I know say if I run do BBL I go be the hottest babe in town wey even Amabe go dey find me everywhere.

Na then I remember Amabe , omo cold catch me as I remember the guy wey fuck me like say eim get personal beef with my toto and when eim lash me from behind, he fire me like say dem stamp eim name for my nyansh. Kai Amabe do me strong thing for body but deep down I still want am, infact who no like better penising.

Then I remember that Alhaji wey bin wan use me for ritual, that one penis sef nearly wound me, chai if not for Amabe jazz naso that man for just end me. — tufiakwa!

I really bin wan see Charles that day, if not for fuck or for money, I bin wan ask am why eim bin dey cry that day when eim bin dey fuck me and how eim take sabi Amabe. All this things full my head to ask Charles but then I never recover from one kind mumu knack wey I go knack inside bus as I dey travel.

Aswear how I take run that package never still clear me as I dey. If Agatha hear that one she go vex for me tire because she don warn me several times say make I no dey knack reckless knack say “All fuck matters” say make I make every knack count.

Normally each knack suppose improve my standard of living but omo that bobo own na just pure adventure and cruise, even though money wey I no even expect still enter from the fuck.

I bin go do one vixen job for one music video shoot, I no even waste time there cuz the place far from my side, even when the director bin try to scope me say make I sleep over say eim go like make we work I just use high bill pursue am, the guy shift one time, because I know say I no fit see better amount of money from that one and that kind person go one use penis shift my womb comot.

Even the artist wey shoot video sef bin dey eye me, I for fuck that one because na one big yahoo boy wey hold money well well, but eim carry eim babe come for location so we no even see space run matter as eim babe no gree am space.

Na as I reach bus park that evening buy ticket, I first begin dey notice this fine bobo wey wan use eyes comot my cloth, this bobo just carry eye gum my body dey look me everywhere I waka, normally I know say I hot and I gather well, but this bobo carry eyes chop me finish.

The bobo sef no bad, e tall, fine, get nice masculine build with wide broad shoulders and eim dress very smart too. Normally as ashawo wey I be say man fine no be my business, my own na make eim bring better money come fuck toto. But I just like everything about this bobo, and me sef I no gree comot eye from the guy.

As we enter bus start journey I notice say na the bobo sit directly behind me, small time the guy lean forward begin talk to me from eim seat, naso we begin gist small small. Ordinary the way the guy take dey talk you go know say na person wey hold money.

After over three hours drive, people begin come down from the bus until e remain only me, the driver, one woman with her pikin, one man wey dey with the driver for front and the fine bobo for my back. na then the bobo come ask me if I go like come sit with am for back.

I first smile shake my head tell am no because I no too trust myself say I no go fuck up but I no know wetin enter me I just get up squeeze myself go back go join the bobo for back.

The guy no even wait make I balance well, na as I sit down, eim wrap eim hand round my neck pull me close to am. The bobo body soft kpa and eim perf still dey scent strong upon say we don journey for over three hours and we bin spend over an hour for park.

As I rest my head for eim shoulder, the guy kiss my forehead, my head spin! As I say make I raise head look am, the next thing na eim soft lips just envelope my lips begin kiss me. i put my hand for eim chest to stop am but my hand weak me. This guy sabi kiss well too, eim lips and tongue suppose follow for the seven wonders of this earth.

Me wey never experience better romance since Charles, I just surrender dey kiss am back, the guy sef confirm say I dey kiss well too. I no mind say few passengers still dey inside the bus, that moment the only thing wey dey inside my head na wetin we dey do.

The guy carry hand go my breasts begin squeeze am gently, aswear e sure me say I moan out small but na lowkey moan and nobody inside the bus hear me. I just dey pray make nobody look back see us. Even if person look back, na person wey look well well go notice wetin dey happen.

The bobo lips soft come dey taste like say I dey lick butter, as we dey kiss, I just remind myself say if I need boyfriend, make I no go use my future husband do customer. The bobo squeeze my breasts me sef carry my hand begin dey undo eim belt sharp sharp.

I comot eim preek, we still gum body well dey baptize our lips and tongue with kiss. I no see eim penis size but wetin I hold for hand fat, big come long and the thing don already hard well. Precum leak full eim preek cap. I use my finger tease the tip of eim penis take am rub the precum everywhere for eim preek.

That time we still get about 30 minutes more before we go reach the last bus stop and I no wan lose guard am. I begin stroke the guy penis fast, as I dey stroke am naso the thing dey hard well for my hand with each stroke.

The small pikin with the woman for the fourth seat row begin cough, the mama turn, dey find something inside her bag, me and the bobo just freeze dey observe until she comot something wey be like water bottle.

Small kiss and boobs caress I don already wet full everywhere, my whole thighs wet like say dem pour okro water between my legs. Sometimes I dey shame with the way I dey take wet for customers before dem chook their preek inside my toto. I go just wet everywhere like say na my lover I dey fuck.

The bobo say make I sit ontop eim leg, I first look eim face for some seconds, that time I just dey calculate the risk and benefit, the guy penis big no be small and I suppose cash out for this kind fuck, but then I just tell myself say make I just catch cruise dey go my way. Na then the bobo put eim hand inside eim back pack bag, do am do am till eim comot condom.

I quickly collect the condom from am, open am, wear am ontop eim erect penis, then I raise myself up, sit ontop eim lap as eim hold eim preek dey guide am inside my wet vagina. Omo the guy penis long well well and e thick, me wey my pussy don wide yakata I still feel the impact of his penetration.

As I sit ontop am finish, e be me like say dem wan divide my body into two through my pussy. I hold the seat for my front dey go up and down small small. As I dey move naso my pussy dey produce more juice dey cream eim preek make the movement dey free. The bobo use eim hand hold my hip dey guide me. anytime the bus pass ontop pothole naso I go jerk ontop the guy wey eim penis sef go enter deep inside me.

We bin dey go slow and steady before the guy hold my waist begin move me fast ontop eim penis, and as I dey land ontop am naso I dey pick myself up dey land back — omo silent fuck sweet die. E get one time the driver suddenly match brake, the guy penis dive enter me finish, I nearly choke, I feel the bobo whole penis deep inside my body.

Everybody inside the bus dey complain about how the driver take match brake without caution dem no know say my own different say na ontop nail I land. Na the time I already dey enjoy the fuck dey bounce of ontop the guy, the bobo realize say we don reach eim bus stop, if you see as the werey fling me comot shout say make the driver stop.

Before the driver stop the bus, come open door, both of us don arrange ourselves, dey like say nothing happen, the bobo give me eim phone say make I put my number as he dey climb down from the bus he call my line I quickly save eim number too. na as the bus zoom off I remember say I no even sabi eim name.

Later that night the bobo call me say make I send am my account number.

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

Norway/NetherlandsFill Norway/Netherlands Form

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 5609 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



Verified by ExactMetrics