November 1, 2025

Yeyegist: Wrong Potion (Chapter 3) [18+]

Home » Yeyegist: Wrong Potion (Chapter 3) [18+]

Yeyegist: Wrong Potion (Chapter 3) [18+]

As Dare begin thrust rapidly with full force my mind tell me say he go soon cum, I begin prepare my mind because I know say if he cum he fit get himself again and we go start our drama again. I prepare myself for how I go take pretend again. Small time Dare begin grunt till he blast eim full load inside me.

Dare no cum finish before he jump again, the remaining spurt of cum fly across the room as he jump comot from the bed. Me too I activate, shout Jesus!

“What is going on?” I begin cry again.

The kind confusion wey dey Dare face and the speed his dick take shrink down, aswear remain small I for laugh.

I run enter the bathroom make I no go burst laugh for his front. Dare stay for the bathroom door dey knock dey beg me tire say he sef no know wetin dey happen. I just dey there dey fake cry dey shout “Go away.”

After sometimes I hear the sound of his belt, I know say he don dey dress up, even as he dey dress he still dey beg me say he no know wetin dey happen. I just dey bathroom dey use hand dey fan my toto, omo the whole place hot like say dem set firewood fire there, all my body just dey boil.

I hear as my door click close, I know say he don waka go, I bath, climb bed sleep well that night. The following morning I wake up with one kind energy wash plate—clean the whole house. That kind fuck wey dey give positive energy.

Tayo call me very early the next morning ask me how the thing go with the guy, I tell her how the guy bin dey follow me the whole place like fly wey dey follow shit. I gist her how me and the guy take fuck well well but I no tell her say the guy na Dare her guy.

Tayo laugh scatter when I tell her how I take rub the powder the second time so that the guy go fuck me again. Me and Tayo laugh the whole matter, I beg her say make she no tell anybody o say shame sef dey catch me. She promise me say nobody go hear the matter.

After the call I say shuu, so na all this thing Tayo dey chop still dey complain say Dare penis too big—jesus! For my mind I say make Dare come swap his penis and energy with Gbenga—omo the guy carry engine and he sabi use am like say na eim calling. Fuck wey sweet me wey I sleep well for night.

Later that day Dare send me one kind long apology message say he no know wetin come over am. Say everything just look unreal for am. He beg say he go find out wetin really happen, say make I just give am time to figure out if na person set us up.

For my mind I just smile as I read the message finish, I say make this guy no go all this prophet go dey ask question o, na him no know as he take fuck me because me I know the genesis to revelation of everything.

Two weeks after that thing happen Dare call me one afternoon say he wan see me, say he dey my house dey wait for me. fear catch me, because me and the guy don dey avoid ourselves since that thing happen and as he say he wan see me I begin reason if something don happen.

I quickly call Tayo to know if anything sup, I take style ask her about Dare, she say everybody dey fine, she no sound like say something happen and I no tell her say her boyfriend say he wan see me.

I beg my neighbor for plaza say make she help me watch my shop say I dey come, because my house no too far from my shop. As I reach my house I see Dare for the front of my apartment, we greet casually but my mind no rest.

Na when I open door wey he follow me enter, Dare come begin para give me say he don find out wetin I do. E be me like say make ground open make I enter. Dare say Tayo gist am the story of how I use jazz for Gbenga but say the thing catch another person and me and the person fuck.

My mouth drop, the same Tayo wey promise me say she no go tell anybody…… Na me go trust bestie!

I begin beg Dare the same way he take beg me that day. nothing I no take beg Dare dey explain say na mistake say I no expect say he go come my house that night, say I bin dey expect Gbenga that night.

Dare own vex be say that day I put the whole blame ontop his head even dey accuse am say he use juju. Say I no suppose pretend say I no know wetin dey happen, say I suppose tell am. Say I for find way tell am. The guy just dey para plenty things dey regret.

I try explain give am say his body bin dey hot and say Tayo tell me say if I no fuck am he go run mad, Dare ask me say why I rub am the second time….. Omo my head spark, so Tayo even give am details say I rub the thing again.

I just bury my head down begin beg am again. Aswear if to say the powder still remain, I for rub am take am fuck Dare again. I ask am if Tayo know say na he be the person, Dare say No say she no know, I begin beg am say make he no tell her say make the thing remain secret between both of us.

Dare just stand there dey vex, I tell Dare say I go do anything to hide our secret. I see as his eyes widen when I talk that one, I say confirm the thing charge eim body small.

Me wey since that day my body dey crave another moment with Dare, the way he hold me, the way he take touch me, the way he fuck me with energy, how he take chop my toto. I make up my mind say I go fuck Dare again take am punish Tayo as she no fit help me keep my secret.

I waka close to am, I put one hand for his chest, Dare no stop me, I see say his heart come dey beat fast like say people dey run inside his chest. I wrap one hand around his neck still dey use the second hand dey rub his chest.

I lean in again, stretch up till our lips touch, Dare no protest, he just stand dey look me as I begin dey kiss am. He no kiss me, na me just dey kiss am until slowly he open mouth gradually begin kiss me back slowly until both of us begin kiss each other aggressively one kind passionate kiss.

This time everybody dey with clear eye, the whole thing dey raw. Dare pull my blouse asap over my head, me I begin unbutton eim shirt, as he sef get busy dey unhook the strap of my bra. I begin unbuckle his belt.

Both of us just dey undress each other fast, our lips still join together our tongues exploring deep inside our mouths, as I dey kick my trouser from my leg. Naso Dare too kick his trouser comot from his leg.

Dem no born Dare to resist me, I complete from head to toe, this time juju no dey his eye, everything I dey see na raw desire, the way he just dey lick his lips dey look my whole body. His preek don stand inside his boxers like say the thing wan tear his boxers. Wetin I like be say the guy no even shame, like say he sef don dey reason to fuck me again. Dare run his hands over my body come smile tell me say I too set, I just laugh one kind ashawo laugh.

I push Dare gently on the bed, straddle am sharp sharp, use my hand dey play with the hairs on his chest. Dare sit up begin suck my breasts, he use his tongue work magic for my nipples, the thing sweet me enter my head as he take his tongue dey circle round my breasts. I just dey swear for Gbenga that one no know pass in and out.

Dare comot his boxers, I slip my hand under, hold his preek—kai I miss this his big penis ehnnn. I look Dare again, tell am say I want make he fuck me without any jazz and say I dey fuck am because say his babe no fit close her mouth.

Dare smile as I try sit ontop his penis, even me sef I shift immediately as I notice say with the way he hard and I never wet well his tool fit tear my punani.

Dare raise me up dive go under me, burry his face for my vagina, begin chop my toto from under, that familiar way wey almost burst me that day for my room. Ahn Ahn! I just dey reason how person go sabi chop toto like say na eim calling.

After he suck my pussy opening well, the bobo move up use tongue tease my clit. My body swell, I plaster my pussy for his face like say I wan suffocate am. As I dey drip naso Dare dey lick my wetness dey lap eim tongue over my toto with expertise.

When Dare see say my pussy don water water like rivers of Babylon, he slide comot from under me, bend me make my bress and chest dey for pillow, I support my weight with my elbow, my nyansh come set up.

Dare position himself behind me, first squeeze my soft nyansh before he come use two hands spread my ass cheeks wide, I think say he don ready to fuck me o, because by then my whole toto don wet dey drip. Next thing Dare bury his face between the balls of my nyansh come to use tongue lick from my pussy lips up to my butthole. Omo that thing tickle me like say dem dash me extra life. I begin laugh like mumu.

Dare do that thing like four good times, na me begin beg am say make he just put preek fuck me abeg, the erotic torture don too much and my pussy don dey on fire. Dare balance back kneel straight for my behind.

My whole body just dey vibrate as I bin dey expect his penis inside me. i stretch the moment he push his monster cock enter my soaking wet vagina. I never see penis wey fill up my entire pussy like Dare penis, preek wey no leave any free space for my vagina….. e occupy everywhere!

Dare no waste time, he begin pump me very fast from behind wey me I just dey shout harder faster, I beg Dare say make he spank me join, Dare obey me dey fuck me dey slap my fat nyansh, mesef I no dull, I wiggle my nyansh everytime eim spank me, the thing sweet am.

He ask me if I like am as he take fuck me… Omo come see confession, I throway the last atom of shame I get left just dey profess how I take miss eim preek say I enjoy the fuck die and na why I rub the powder the second time.

We still dey fuck when my phone begin ring for my side….i look the screen na Tayo dey call me, Tayo my bestie, Dare girlfriend. I bin wan ignore the call but Dare say make I pick am, make e no be say she don dey come my house because he park car outside. As I answer her call, Dare slow down small dey thrust slowly. I tell Tayo say I go call her later say I dey fuck that guy wey that jazz catch that night. Tayo shout tell me say I be bad girl, she say she go call me later make I gist her as e take go, I just laugh end the call.

She no know say as we dey talk, her man penis dey inside my body. As I end the call I drop the phone back, I laugh, make I fuck her man well well, I go gist her later. I push Dare make he lie on his back, I climb am asap lower myself ontop his stiff preek slowly. This time my slippery wet pussy swallow his preek one time. I begin hump ontop am.

As I dey bounce up and down ontop Dare, I make up my mind say I go keep Dare as my sex machine, and I go dey fuck am as far as my bestie no go fit close her mouth. Me and her man go dey fuck and she no go ever know, after all if to say she no tell her man about wetin happen, me and Dare for still dey avoid ourselves and we no for dey fuck again.

I look Dare, Dare smile like say he dey read my mind, I no send if she go tell Gbenga this time as far as her own man sef don dey my hand!

Written by D.N.D

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 4519 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



All Time Favorites

Verified by ExactMetrics