December 5, 2025

Yeyegist: Okada Man’s Diary (Chapter 4)[18+]

Home » Yeyegist: Okada Man’s Diary (Chapter 4)[18+]

Yeyegist: Okada Man’s Diary (Chapter 4)[18+]

Before I look front, look back, policemen don jack me put inside hilux. I begin shout say I no follow. Na as I enter the Hilux, I realise say na Okada men dey come pack for junction that night, because almost all my colleagues wey we dey stay for that junction dey inside the Hilux.

As dem begin drive comot, me and other okada men just dey shout say make dem help us carry our okada. dem no even answer us, dem just drive us go station.

Na when we reach station, I hear say one okada man wey dey stay for that our junction break bottle ontop policeman head.

I say shuuu… so dem gather innocent me join because of something wey happen for afternoon when I still dey factory dey work. I try explain give one of the policeman say I no follow say I bin dey my working place when the thing happen. The officer no even look my side.

Small time dem collect our phones, I just dey think about my bike wey dey for road, one of my colleagues say dem go bring am come station say make we no worry, until we hear when one of the officer dey tell another one say make dem leave our bike say when dem thief am na then we go vex expose the person wey break police head with bottle.

Omo thief keh? I begin beg dem say no be me get the okada say na hired purchase I take collect am.

Fear no gree me rest, I go meet one particular female officer, I explain everything give her. I just dey beg her, at first she no even look my side. As I continue to dey worry her she look me say

“This fine boy you dey worry me o.” before she come ask me wetin I want make she do for me. I tell her say I want make she free me. she say that one no possible, say the only thing she fit help me do na to bring my bike come but say I go pay her 50k, I nearly shout!

We begin bargain price until she finally agree to bring my bike for me for 20k… omo I no get choice, e better make I pay the money than make dem collect the bike.  She say I go pay her before she go bring the bike, I no get choice sha I agree.

She help me collect my phone, I transfer the money give her, still describe my bike for her, give her the key.

Small time the woman return with my bike, she park am for one side for the station, sneak the key give me back. my mind come down. As night cover them wan begin put us for cell, na that one I no gree o, I tell dem say I no wan enter cell.

For my life I never enter police station before, come be cell for wetin I no know about. I meet that police woman again, tell her say I no wan sleep for cell, she laugh tell me say nothing go happen, say na just one night, say tomorrow morning I go dey go house.

Omo I no gree o, I beg her say I go do anything. She come serious tell me say make I arrange 100k, my mouth drop.

I just give up say I go stay, until she come meet me later ask me how much I get. Naso we begin bargain till she agree 30k. she go bring my phone come give me I run 30k give her.

As dem dey move everybody go cell, she tell one officer say me and her come from the same village and I dey sick, say make dem find space for behind counter or any office keep me, say she no go want make I stay for cell. The officer tell me say make I sit down for one bench.

I check time for my wristwatch 12pm, mosquito no even gree me close eyes. Even the noise from the people wey dey cell too no gree me rest, I just dey imagine say I for dey with dem if to say i no play smart.

One of the officers wey dey behind counter with me don open mouth dey sleep, the other one dey watch film for eim phone. Na then the female police officer wey bin assist me enter, she don comot uniform, she be like person wey just baff finish. she don change to one kind small loose gown wey short for her thighs.

I just dey wonder where she dey go for night where she dress like ashawo.

As she near me, na soso perfume I just dey scent, she fresh, her body just dey shine. she go meet the officer wey bin dey watch film dey follow am talk. I just take time dey look her thick laps and large breasts.

I look her breasts again, me wey like breasts, the thing big dey very juicy. Everywhere for her body just big get meat, but na her ass enter my eyes pass. Even as the gown no tight at all, I still see as her nyansh set.

I wonder wetin go make woman reason say na police she wan do. I see as the other officer just dey hold her hand dey touch her hair, dey touch her body my mind tell me say the two of dem fit dey fuck for night.

After some time she finish with the officer come waka meet me tell me say make I come, say e get one office wey I fit sleep inside, she say she just dey do am because say I pay her and I be like better person.

For my mind, I say ‘Hiaaan nice Nigerian police…. Toor.’ As she dey waka for my front, her nyansh just dey shake like say all the nuts for her hips don comot. For my mind I say if we work well I go collect her number make we reason matter later.

I follow her enter one office like that, e be like interrogation room wey I dey see for film because na only chair and table dey inside. She say I fit sit on the chair or lie for the table if I want, make I just dey for the night say mosquito no dey the room.

Before she comot she off light tell me say make I just dey quiet say she go come check me later. I hear as she lock the door with key as she step out of the room.

Sleep no gree come, morning sef no gree come too. I just dey think, see as I land for station…choi. I check time for my watch, few minutes past 1am. E come be like say dem press slow motion for the night.

Time just dey crawl like say e wan punish me. Small time I hear key for the door say person dey open am. As the door open, from the light for the passage I see say na the police woman. She no switch on the light, instead na phone torch she hold shine for my face, I use my hand block the light as e shine enter my eyes.

She lock the door waka come meet me. she drop the phone for the table come whisper ask me if I wan piss. I shake head tell her no… she ask if I eat anything before dem arrest me, I say yes. Because na food I chop finish go piss before dem carry me.

Next thing this woman waka come my front begin fold the gown wey she wear up…. Before I fit say ‘penis’ she don straddle me ontop the chair.

The poor wooden chair creak tire as e carry our weight. Na the scent of her cheap perfume first full my nose before I notice say the perfume dey battle with one kind strong body odour for her body. Her breasts cover my face finish, I no even know where I suppose drop my hand, I first drop am for my sides dey look her, before I gradually hold her to steady her for my laps.

Omo this woman get weight die! Blood flow from my leg reduce instantly but, wetin give me motivation na the heat from the middle of her thighs wey be like say e wan burn my trouser. E get wetin my mind tell me but I discard am say e no fit be true, after all when I bin dey waka behind her dey I see pant line through her gown.

But na when she carry my hands place am for her nyansh e dawn on me say na raw warm human flesh my hand touch. She no wear anything under the gown, she don comot the pant. Two seconds my foolish penis begin hard under her weight, preek wey no get sense dey hard for police officer inside police station.

I dey tempted to grab her nyansh but I just dey tell myself oga easy… this thing fit be setup, no trust police.

She let out one kind low moan begin grind her nyansh ontop me. my penis charge say what! Small time she comot the strap of her gown push am down to her belle.

Na her gigantic breasts inside black bra face me. the bra just dey smell sweat, I know say e fit don dey do fifteen days anniversary for her body. I make sure say my fingers graze her back as i slowly unclasp her bra.

The thing enter her, she push her full breasts to my face.

If you see the kind long breasts wey wobble out as the bra free her breasts, the whole mountain I been dey admire since inside cloth just flat like water fall. Disappointment grip me. for my mind I say

“Choi if not for bra” But I decide say I go manage am, after all nothing better dey comot from police station. I first suck and swirl my tongue around her nipples before I take mouth bite her nipple, she hiss, wrap hand around my neck, dey rub my head like say she dey wash am with invisible shampoo.

Me I just dey do suck one breasts, squeeze one breasts. If I dey suck one, I go dey squeeze the other one, then I go switch.

My free hand grab her nyansh tight, she moan.  She raise herself up, put her two legs for ground, begin undo my trouser button, I say make I see the condition of her toto. As my finger near that way, e be like say dem pour okra water inside that place, everywhere just wet and slippery.

She don dey aroused. Her toto solid like blow, the flesh around am thick like fence. When my hand reach her clitoris, aswear I first think say na small pikin penis I touch. I begin tickle am small small with my finger, she just dey shake leg like person wey dey dance Awilo dey press my head for her breasts.

She comot my penis out, hold am upright like stick come begin lower herself down ontop my preek. Both of us no even too stress am because her toto wide and she don wet scatter, my preek zoom enter her one time.

As she lower herself completely ontop my lap, her sopping wet pussy eagerly accept my cock. She balance her hands for my shoulder come begin move up and down slowly.

If any prophet tell me for this my life say I go fuck police officer inside police station aswear I no go ever believe.

Joy full my body for this kind adventure. she begin bounce ontop me fast, she go bounce small then grind herself small. We bin try to keep our fuck as silent as possible silent, na only the sound of the chair and our breathes full the room.

As she dey bounce naso she dey sweat add and na so the odour dey overpower her perfume but that one no concern me. na the fuck wey I dey fuck dey my mind.

E reach when she begin do am like say we dey fight, she increase pace dey hump ontop me like say she wan end me. for my mind I say this kind death sentence for station na ‘death by fucking.’ She begin dey make one

“Hmmmm…mmmm….mmmm” sound as she dey move up and down. Me sef I no mercy for her breasts, as I dey bite am naso I dey suck am, dey make her craze add.

As she dey jump up and down ontop me like say spring dey her nyansh, we hear noise outside, I quickly grab her sides, she pause, we hear as officers dey shout, I hear people voice wey dey beg like I bin dey beg when we dey junction.

I know say they don bring boys come back from midnight patrol. The whole place bin dey very noisy. Slowly she continue from where she stop dey bounce ontop me until she pick up full pace again. As the whole place dey noisy that time, all the sound we dey make no even sound pass the room.

Her toto don wet dey flood, I grab her nyansh try to fuck her from under, but the chair bin dey make too much noise so I stop. I just continue to dey guide as she dey move ontop me.

After some time, I raise her up position her make she hold the table. I jam my penis inside her dripping cunt again from behind, begin fire her better doggy. Na for that doggy I earn my respect from her. we fuck like wild animals, sweat pouring from our bodies.

I squeeze her nyansh as I pump her fast deep strokes. until she begin bounce her nyansh dey fuck me back. I ram her pussy with speed sotey she begin cry dey shout “yes sir… yes sir…fuck me sir” I say shuu police office dey call me sir., she just dey hail me dey make noise full the whole room.

I try quiet her, but she no even answer me person wey preek don scatter her formation.

When I tell her say I wan cum, she say yes…yes say make I pour am inside her, I say toor, immediately, my penis explode inside her. as I dey spurt my cum inside her hot toto, this woman jam her nyansh for my waist, they whine am, e sweet me ehnn, for my mind I say hope this woman no go get belle, because all this thick people dey over fertile. Wetin even sweet me pass na the way she open leg stagger as she waka comot from the office when we finish. the whole office just dey smell fuck fuck, I just dey wonder who go first enter there that morning.

I no see her again until morning reach. By morning, dem allow us make call, I call my in-law wey be lawyer, na eim rush come bail me that morning. Before we comot from the station I find the female police officer, I no see her.

I codedly ask one of the officers about her. The officer tell me say she don go house. I take style ask the officer again if she don marry. The man look me say she be mother of five and say her husband sef na soildier man.

Fear hold me, I no even bother collect her number again. Naso I comot from the station with one new record.

Written by DND

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 193 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



All Time Favorites

error: Content is protected !!!
Verified by ExactMetrics