June 17, 2026
Yeyegist: Cooking Lessons with Tolani (Chapter 8) [18+]

Home » Yeyegist: Cooking Lessons with Tolani (Chapter 8) [18+]

Yeyegist: Cooking Lessons with Tolani (Chapter 8) [18+]

I quietly circle around go the other side, me wey like amebo, I tiptoe enter the generator through the second entrance, na then I see the whole thing clear, Idris hold one woman waist dey fire her sharp doggy from behind.

I see say the lady wear black trouser wey she comot down reach her knee, she wear while polo wey Idris don already fold for her back. The white and black attire already confirm am say na one of the lobby attendants, Idris, dey fuck.

Na when I sight the nyansh very well, I confirm am say na Busayo Idris dey fuck because na only she get that kind big fat water water yansh for my workplace.

Omo, if you see as Idris focus, hold Busayo waist, dey slam her big nyansh proper doggy from behind, like say na him major work be that.

From the angle wey I stand dey look dem, I see everything clear like say na cinema. Idris penis long die, e no fat, no thick, just long cock wey curve like harvesting tool. I no dey like penis wey no fat, but wetin muse me for Idris penis na the fine way the thing curve.

That kind curve preek dey easily reach G-spot well well. I see as him hips dey move like engine, as eim grab her breasts with force dey drill her like say eim dey dig well, pounding that her big nyansh with high speed.

I sure say with the kind speed and hard slamming he take dey fuck her, Busayo go dey make one kind loud noise, dey scatter everywhere with loud moans, because nobody go take that kind hard banging with that him long curved penis wey no go shout.

But the loud sound of the generator bury their sound entirely. Shame catch me for Busayo say after all the flaunt she dey flaunt that her massive nyansh like gold for everybody face, na inside generator house she dey throway am for utility staff.

That night I watch the whole thing till Idris cum, body shaking like leaf. Shame catch me for both of them, but I no talk, I no tell anybody, I no even tell Busayo say I see her where Idris dey fuck her, I just die the whole matter. After all, everybody get their secret.

But Tiwa? She no get that kind mercy. The day wey she catch two of dem where dem dey fuck inside the gateman post one night during nightshift, na only God know wetin carry her waka reach there that night.

My mind still dey tell me say e get somebody wey set Busayo up that night. probably one of her colleagues wey know say she and Idris dey fuck go cast the matter tell Tiwa say dem dey knack for maintenance office.

Trust Tiwa not to disappoint, she raise alarm immediately, call everybody gather to come see them, that night na complete drama. The following morning the news spread reach all of us wey no do nightshift that night.

Everybody dey talk about the matter. Before 9am that next day, management sack Busayo and Idris. Honestly that matter pain me ehnnn…. Because I don see them before and I no talk, I no say anything, but Tiwa she no fit help am she must cast anything.

Now wey my own case na woman-to-woman — that one Tiwa go use am bury both me with joy. I know say for her mind she don already dey plot my own downfall.

The only thing wey dey hold her fit be because say she like Felicia and she know say anything she do me fit affect Felicia. And besides Felicia na our madam favorite staff, maybe she just dey thread cautiously make she no go shoot herself for leg.

Then one hot afternoon, when the pressure from Tiwa don too much, I just vex, I gather mind, march go Felicia office. I say make I tell her as our supervisor say make she cut better warning give Tiwa before we go wound ourselves.

At all at all, management go sack both of us by the time we go fight, but e sure me say I go don comot like 4 of her teeth still give her better handicap. Her whole bad belle and witch hunting don hook me for neck. Tiwa just gather mind say she go frustrate me finish, she no gree me drink water drop cup.

But when I enter Felicia office that afternoon, I no meet her. One other girl wey I jam outside the office tell me say she see Felicia when she enter staff lodge few moments ago.

I no even think am two times, with the kind para wey full my body, I just begin march dey go the staff lodge side. Na as I reach very close to the staff lodge my heart begin beat fast. Na then e dawn on me say e no safe at all to go meet Felicia for staff lodge — especially inside her room.

Too risky. What if she fit begin dey touch me again. what if Tiwa or somebody else catch us this time.

But the vex wey full my body no gree me reason. Anger don block my sense. I no even send. I decide say I go pass the second gate entrance — the back route wey dey closer to Felicia room, so that nobody go see me.

My heart dey beat fast as I near her room, I reason am to turn back go wait for her make she return back to her office, but then I but I press on, if I back off now go wait for her, the anger wey dey my body fit don subside before Felicia go come out and I want make she feel the full force of my anger when I dey report Tiwa to her.

Na as I near Felicia window I hear the first deep moan. The moan loud and sharp — that kind wey dey comot from serious, deep pleasure. I freeze! “Who dey with Felicia?” My mind begin race.

I bin leave Tiwa for kitchen area where she dey para give me, definitely no be she dey inside the room with Felicia, so who come dey inside? Abi Felicia dey fuck another person?

I tiptoe go the first window, e dey close, but even as e close I still hear the sharp moan again, this time louder. Curiosity wan kill me. I rugged myself, squeeze my body go the second window — the one wey dey very tight against the fence.

Na there the window open small, probably dey open am make fresh breeze dey enter. The moment I bend my head look inside, my eyes nearly pop out.

Felicia still dey fully dressed in her supervisor uniform, but the other female figure on top the bed dey completely naked. Her thick, fair thighs dey wide open, knees bent.

Felicia kneel between the person legs, both hands dey play with the woman’s big breasts, squeezing and pulling the person nipples like say na toy she dey play with.

At first, I no see the other woman face at all because of the angle where I dey and the position wey the woman dey for the bed. But I see say the female body fat and fair… my mind begin race through everybody for our work place wey fat and fair.

One na Iyabo one thick fair lady, but Iyabo dey off duty that day. The second person wey fair, come get body like that na Rose, the one wey tell me say she see Felicia for staff quarters….. so definitely no be she too, unless na Iyabo wey come around.

The moan explode again — sharp and desperate. As Felicia bend her head low, bury her mouth on the woman’s pussy. The sound wey follow na pure madness.

The woman begin wail like puppy wey dem abandon, her hand dive for Felicia low-cut hair, pressing her face deeper.

Felicia no play at all. She chop the woman punani with serious hunger. She do that her long, slow, wet strokes of her tongue from the bottom of the woman slit up to her clit, then suck the swollen clit hard.

Felicia suck am deep like say she wan drain all the woman juice, then she release am with loud pop sound before diving back in. Her two hands still dey squeeze the woman’s heavy breasts, pinching her nipples rough.

The woman just dey twist her body, dey grind her fat nyansh for Felicia face, moaning loud, without control. “Feli… oh yea… fuck… eat it… that’s good.”

I try to fix the voice, but nobody come to my head. Maybe because I don completely lose focus at that point. Felicia increase her pace. She push two fingers inside her dripping pussy begin finger-fuck the female fast and deep while her tongue dey flog the clit non-stop.

The wet “chokor chokor chokor” sound fill the room. The woman body begin shake, her thick thighs vibrate around Felicia head. I just stand there for the window, eyes wide with shock, my own pussy don already flood inside my pant. My nipples don hard like stone. I no fit believe wetin I dey see, still dey imagine who the woman be.

My hand slowly slide inside my skirt by itself. I push my pant aside begin rub my own clit as I dey watch.

The more Felicia suck and finger the woman, the faster my own finger move. I wish say na me dey that bed spread leg open like letter Y. I wish say na my own pussy Felicia tongue dey punish like that.

Felicia suddenly stand up, quick quick comot all her clothes. Her body sharp and sexy, breasts small like fist, deep navel with hairy pussy like mangrove forest. That day wey me and her do our own she no comot clothe, na now I see her body well.

She climb on top the woman, spread her own legs wide, straddle the woman come begin press her wet pussy directly on top the woman own.

Felicia begin grind hard — pussy on pussy, clit rubbing clit, their juices mixing. Both of them begin dey moan loud. Felicia move her waist in fast, smooth circles, then long strokes, she press down hard so that their clits kiss each other with pressure.

Their big breasts rub together as Felicia lean forward. The sound of wet pussy grinding drive me crazy. The woman grip Felicia nyansh tight, pull her closer as she dey moan: “I’m close… I’m close… fuck me like that!”

Felicia grind faster, harder, her own moans joining. Their bodies dey shake together. Few seconds later, the woman body stiffen, she squirt hard, her juices shooting out, soaking Felicia pussy and the bedsheet. Felicia no stop. She grind even harder on the squirting pussy until her own body shake violently.

Both of them cum together, moaning and grinding like say the world wan end.

I dey where I stand dey finger myself fast outside the window, biting my lip so I no go moan. My own legs sef dey shake small. Then suddenly the woman phone begin ring loud on the bed.

Na as she stretch her hand, pick the phone, come sit up sharply. I see who the person be. Blood of Hosea and Zephaniah! Na our Madam kpatakpata — Madam Glory! The owner of the whole restaurant.

The big woman wey everybody dey fear. The same woman wey dey always act like saint… so na her pussy Felicia dey devour like this?

My finger still dey inside my pussy as my eyes nearly drop from my head. I see as Madam Glory breasts still dey rise and fall from the orgasm, her pussy still shiny with her juice and Felicia own.

Felicia just sit down dey smile that her dangerous smile. Felicia lean forward kiss Madam Glory deeply for her forehead as that one dey talk to person over the phone.

My whole body weak instantly. My legs nearly cut off as I watch my own Madam — Madam Glory, so na she bin dey lie naked ontop Felicia bed, thick thighs wide open, dey moan like one cheap ashawo while Felicia dey finger her pussy like say she dey dig tunnel.

No wonder Madam no dey take Felicia play at all. All that special treatment, all the “Felicia is different” talk… na pussy connection be the main thing. Deep, dirty, powerful connection.

I sure say Tiwa no know this one at all, even if she know e no get wetin she fit do, because definitely she no fit fight Madam Glory.

Na for that window I dey when I make up my mind say I go use this connection to my own advantage!

My heart hammer inside my chest. If anybody catch me here now, my own don finish be that. Sack letter go be the smallest punishment. I quick crawl back jeje like thief, squeeze myself comot from the window area, find my way out of the staff quarters without looking back.

By the time I reach outside, I no even follow anybody talk. Na me and my eyes wey don see abomination.

I just carry myself go one quiet corner for the compound, dey reason things. Since Felicia and Madam dey like five and six, one dirty alignment enter my head: maybe I fit align with both of them and use the connection shift Deji one side at least even if me and am break up I go still get my work… or use am comot Tiwa entirely.

The thought sweet me and scare me at the same time. As I dey pass through the lobby dey go back to the kitchen, one familiar voice call my name. “B-shine!” I first freeze, person wey go fit call me me B-shine na person wey know me from way back.

I turn round slowly — na then my eye jam Kola. If you see as I scream jump ontop am, I no fit even hold myself. I wrap my legs around eim waist as he grab my yansh hold me tight.

Kola na one big Yahoo boy wey I sabi from my old hotel days when I bin work as room service for one big hotel around town, long before I begin work for Madam Glory restaurant.

Every other worker just dey use one kind eye look me because dem never ever see me do person like that, but I no send… Kai e don tey wey I see Kola last. The last time I jam one of his friend ask about am from his friend, that one tell me say Kola travel out of the country.

Written by DND

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 1262 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



All Time Favorites

error: Content is protected !!!
Verified by ExactMetrics