September 16, 2026
Yeyegist: Minister of Enjoyment (Chapter 6)[18+]

Home » Yeyegist: Minister of Enjoyment (Chapter 6)[18+]

Yeyegist: Minister of Enjoyment (Chapter 6)[18+]

I no gree comot from my room. I just sit down for the edge of the bed dey reason the kind temptation Kelechi go use finish me this time wey she come.

From the way she take hug me tight when she greet me downstairs, I don already smell serious trouble. Her soft breasts press my chest like warm foam. The memory of her last visit refresh immediately, how she almost make me lose control for kitchen that Sunday morning.

Normally Nkiruka suppose tell me say her sister dey come spend weekend. But she no tell me anything. I no blame her, na me cause am.

Na me give her too much odoyo to dey misbehave, in the name of love. My wife no even dey see me as head of house again. if she want anything and I no concur, she go rebel turn the house to military zone, begin plan coup for me inside my own house.

One day this woman go pursue me from my own house if I no take time. If I no tame her sharp-sharp, na me go chop the shit.

I blame myself, na me open door give her chance to chook hand inside every corner of my life. Even Uchechi, my personal secretary for chambers—na still my wife pick her for me. I know say she plant that girl to dey watch me, to report if I run any matter with any female lawyer or client.

For Nkiruka mind, Uchechi na pure saint. Only if she know say the same “innocent” girl she bring come spy on me don dey enter my eyes. I don dey notice the way Uchechi go bend for my table anytime we dey sort any case file, the way her clothes don dey get opening for sensitive places… na me know how I dey hold myself. If no be self-control, I for don knack that her since.

Vex swell inside my chest. Why I go dey hide myself inside my room like chicken for my own house because of my wife sister? I open the door, waka go kitchen check for food. All the pots clean, empty, dey shine under the light.

The thing surprise me. Normally if Kelechi come visit she go first enter kitchen cook something. This time she no even near kitchen. I know say na her sister tell her make she no cook.

Yeye thoughts begin play inside my head. Abi make I fuck Kelechi take am punish my wife. After all na she bring temptation come meet me.

As I pass Kelechi room door I hear her voice, soft, laughing small like she dey on phone. I press my ear against the door to try hear who she dey talk to, but television sound from inside no gree me catch anything clear.

Since I travel for three days come back, I never touch woman. I bin dey hope say when I return I go fuck my wife well. But since I land na cat and rat me and Nkiruka dey do because of Sandra. One mind tell me to Knock.

Ask Kelechi why she no prepare food. If she seduce me, I go fuck her well-well right there.

Another mind tell me say make I leave am. Na just small thing bin dey hold me, say she be my wife sister, and if the matter cast e go scatter everything. I enter my room, change cloth, carry car key.

As I dey waka down the hallway toward the staircase, Kelechi room door open. She step out in one tiny black lace bra wey no even cover half of her big, heavy breasts with small matching knicker. Her phone still press for her ear.

I stop. My legs no gree move. My eyes lock on the soft swell of her breasts, the deep cleavage, the way the thin lace strain against her nipples. I turn quickly, begin pretend like say I dey find something for the beap of bedsheets wey dey the small table wey dey the hallway.

As soon as Kelechi notice me, she quickly tell the person on the other end say make the person “Hold on small…” Then she turn, smile, voice casual like nothing dey. “Brother Chika are you driving out”

“Yes” I reply quickly, my eyes still dey the table.

Can I join you please, so you can drop me at the market please? Nk wants me to get some items from the market.”

Na then I turn to her. My eyes lock for her chest like say na my permanent destination. One mad mind scream, push this girl for wall, fuck her now. I know say she no go even stop me because na wetin she want sef.

My body dey hungry. But liver cut me. Na my wife sister.  I just nod. “Be fast please, I’ll be waiting in the car.”

Throughout the drive I no fit think straight. As I dey drive, dey look front, my eyes still dey roam around the large stretch of smooth thighs the short leather skirt Kelechi wear reveal.

The tank top she change into no better than the bra, with no bra underneath, her nipples point hard against the thin cloth like dem dey advertise themselves. She sit quiet, head down, dey press her phone.

I wonder how she fit wear that kind cloth for road and feel comfortable. I tell myself say that one no concern me, after all my wife dey see her sister wear all this nonsense and she no complain.

Na when we reach one long traffic light wey everything change.  I focus dey look the other side of the road where some people dey dance for roadside product promo. Suddenly warm hand land on my trouser buckle. I swing my head sharp my eyes meet Kelechi dey smile—slow, wicked, pretty like demon.

I open mouth to talk but words no comot. I raise hand to push her away, but instead, hand wey suppose stop her rest for her shoulder. My whole body weaken. All the blood for my body rush straight to my penis as she open the zip, slide her soft hand inside, bring my stiff cock out. Her warm, smooth fingers wrap around my shaft like fish roll. She begin stroke am gently, sliding up and down slowly.

I throw my head back against the seat, fix my eyes on the car roof so that I no go look her face. For my mind I say kai, this girl don catch me finally. Her hand soft like the inside of pussy, warm and sure. Sixty seconds traffic light be like sixty hours. My entire body dey shiver. My cock stand thick and hard inside her fist, leaking already.

I no bother about outside, the glass of my car dey tinted. One of my hand still rest on Kelechi shoulder while the other grip the steering wheel tight. I trail the hand from her shoulder down, dip inside the loose tank top, my hand find her bare breasts.

Soft, heavy, full. I begin observe am, i squeeze am dey move my fingers until my fingers locate the hard nipples. I roll them gently between my thumb and index finger.

Kelechi moan low, her hand still on my cock. She speed up the stroking, begin stoke faster, tighter strokes, thumb circling the wet head.  The traffic light still red like danger. My cock bin dey jerk hard inside her fist.

For that moment, inside the tinted car, the only sound na her soft breathing and the wet sound of her hand working me.

Me I just dey fondle her breasts rough inside the tank top, fingers sinking into the soft heavy flesh, I pinch her hard nipples until she release longer, deeper moans. Kelechi handjob nearly burst my head.

The girl sabi stroke preek like say she learn am for special school. Tight grip, perfect rhythm, thumb circling the wet head each time she slide up. The sweetness make me press my nyansh hard into the car seat, hips pushing up into her fist, wishing say we fit do more right there.

Next thing Kelechi lean down without warning. She take one long, wet suck from the swollen head downward. Her mouth no take my full length, but she swallow something reasonable, hot, tight, sudden.

The heat from her mouth be like oven. I gasp sharp, hips shoot up off the seat. My hand grab her shoulder tight. She pull off, then do am again, deeper the second time, before she swirl her soft tongue slow around the sensitive head, lick my precum. Shortness of breath nearly finish me. My eyes roll back.

Piiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiiii! The long angry blast of horns from the cars behind hit like attack. I first hear the loud sound but e be like say e dey come from another world. Until reality slap me. I jerk upright, look front. One traffic warden already dey waka straight toward my car, face tight. Behind us plenty cars dey blast horn like say I hold their kidney.

Kelechi ease herself up sharp-sharp, wipe her mouth with the back of her hand, sit proper. I slam the gear, drive off before the warden reach the window. I no even know how many seconds I don delay for that light.

Both of us just quiet inside the motor like two strangers wey never meet before. Guilt wan finish me, I side-eye her small. I wonder if she dey regret wetin just happen, or wetin dey run through her mind.

E just dey do me like say make I disappear, drive this car in ghost mode. On the other hand another thought enter. Carry her go one of these hotels around here. Finish wetin we don start. Fuck her proper. I brush the thought off quick.

We no talk one word until we reach the market. My heart just dey beat fast. What if na NK plan am, what if she tell my wife. What if na set up? The what ifs wey enter my head within that short period of time reach ten thousand.

The silence inside the car dey uncomfortable sotey I no know when I switch on the radio, make something just calm the tension inside my body. Na the way Kelechi just balance quietly dey busy with her phone surprise me pass. She just do like say nothing happen between us. Na her calmness unsettle me pass. What if she record the whole thing? Ahhh I don die be that!

But upon all the regrets and fear, my cock still bin dey throb inside my trouser, hard and angry, as if e dey ask why I stop.

As she reach for the door handle to climb down, I finally talk, voice low.

“I… I’m sorry about what happened.”

Kelechi just turn, give me that same small wicked smile, wave her hand. “Never mind, I understand.”

She open the door, step out from the car, begin waka enter the market crowd. I stay inside the car dey watch her as she waka comot, her heavy nyansh swinging left-right inside the short leather skirt like pendulum—soft, full, deliberate.

Every step make the skirt rise small, showing more of those smooth thighs.

As I continue to drive through the market, my head hot, e be me like say e wan split. The effect of Kelechi mouth for my penis still full my body.

The wet heat, the swirl of her tongue for my dick head, the way she suck am— the sensation no gree leave my preek. “Arrange this girl, fuck am make your body rest after all you don see her toto and she don suck your preek.” Me and Kelechi don already do almost everything wey surround sex.

Na only preek I never put inside her toto. So wetin really be the difference again?

I look the tiny road she enter, then I look my phone. I shake my head, turn the steering right, the direction that led me out of the market into the main town. Self-control win again!

Since hope still dey say dem go cook something for house, and me I no like to dey chop outside, I just drive go one of my padi house inside town.

We play snooker till evening. I yarn am about Sandra and all the wahala wey dey happen for my house, but I no tell am wetin Kelechi and me do inside the motor that afternoon. Some things better remain for chest.

My guy ginger me say make I no let my wife control me, say make I exert authority for my house. My padi tell me plenty things, na then me sef I realize say I don too loose guard for Nkiruka.

Later that night as I reach house, I first stop for kitchen. No scent of food. Pots clean. Dining table empty. Nothing! As I climb the staircase I meet Nkiruka as she comot from Kelechi room. She still dey fully dressed in her office clothes—like say she just dey return from work by almost 9pm.

Na only me know the level of vex wey full my body. “Why is there no food in this house?” I ask NK, voice already heavy.

Nkiruka look me up and down, like say she dey see me for the first time. “You can see I’m just returning from work. I decided to spend some time with Sandra at the hotel.”

My head spark. Which kind yeye talk be that? I know say she dey intentionally do everything to pepper me because I no gree Sandra stay but aswear e don too much. And the way she talk am so casual, already turning to waka leave me, na that one vex me pass. I remember all the OT my friend give me that evening. I remember how he look me for eye tell me say na me pay her dowry and I pay everything, I no owe her people one shishi. Na me marry my wife, no be my wife marry me, so make I act as a man wey marry woman.

The speed I take jump, rush NK as she begin move, you go think say one movie director stand somewhere shout action! I grab the strap of her handbag drag her back.

Written by DND

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 1866 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Follow @deolububble

Instagram has returned empty data. Please authorize your Instagram account in the plugin settings .

Premium Stories



All Time Favorites

error: Content is protected !!!
Verified by ExactMetrics