November 4, 2026
Yeyegist: Man of the People (Part 1)[18+]

Yeyegist: Man of the People (Part 1)[18+]
Home » Yeyegist: Man of the People (Part 1)[18+]

Yeyegist: Man of the People (Part 1)[18+]

Very early for morning, my phone don begin ring nonstop like say I be telecom customer care agent wey dem dey call every second. Thank God say the phone dey on vibration mode, if not, the whole room for don explode with the number of calls wey enter the phone.

I no answer any of the call… I already sabi say na people wey wan get more information about the political campaign wey we get that morning dey call me.

I turn look my side. Toyosi still fold for bed dey sleep like innocent pikin, person wey see her dey sleep peacefully no go know say she sabi fuck like machine. Me sef I don weak, no be small fuck we fuck almost throughout the whole night. I look Toyosi body from head down, I bite my lower lip, my body sweet me, so na me chop this fine full body last night?

I pick my phone, switch on data. Immediately, messages begin flood in like tsunami. The notification sound make Toyosi shift small for bed. I quickly reduce the volume make I no disturb her, but by then she don already wake.

She raise her head, look me, smile one soft smile, then she shift herself, climb ontop of me. She kneel, straddle me, put me for the middle of her knees. Her soft heavy breasts press hard on my chest, her face bury deep for my neck.

I keep my phone gently for the side of the bed, begin rub her back gently. Apart from the small pink tank top wey she wear, Toyosi no wear anything down. She don comot her pant and skirt since we begin fuck for parlor the previous night.

I wonder which corner for parlor her pant fall when I fling am that night. I feel the hot wet heat of her pussy press against my crotch as she begin push her pelvis down on me. My hand trail go down, grab her full yansh. Her body stiffen, then she begin lick my neck, dey suck my neck.

As she dey suck my neck, she start to dey rock her pussy small small, dey grind her swollen clitoris against my preek wey don already harden inside boxers. I sabi that invitation too well. I use one hand raise one of her thick butt cheeks up, use the other hand pull my dick out, guide am straight inside her toto.

I push my penis deep up inside her one sharp thrust. Ahhh fuck… I shock. She don already wet kpatakpata. Her pussy swallow my dick like say e dey hungry. E grip me from head to shaft. I wonder if na only that small grinding she do wey make her toto wet abi she don wet since she wake up.

The heat, the tightness, the wetness… My two hands grip her yansh balls tight, my fingers dig into her soft flesh. Her low moans enter my head as I begin ram my dick deep inside her from beneath. Hard, deep and steady pumps. Every thrust make her pussy make wet watery sound. Toyosi bury her face for my neck, dey chop my skin like vampire.

She no bounce on me, she no rock or grind like she do when we first fuck for parlor the previous night. She just remain like that ontop me, her face buried for my neck, her heavy breasts crush my chest, her wet tight pussy gripping and milking my penis every time I pump up into her.

I fuck Toyosi harder. My waist move up and down, slamming deep into her, the wet sound of our bodies as e dey jam fill my quiet room. Her toto contract around me, squeeze me, like say e no wan let me comot.

My balls tighten. I hold her yansh tighter, pump faster, deeper, until I blast another thick load of cum straight inside her. Third time I dey cum inside that same pussy for one night. I pray say make God help me make she no get belle as my sperm dey shoot in.

We stay like that for sometime, my dick still throbbing inside her, her body heavy and soft ontop me. Then she comot her head from my neck, kiss me slow for my lips, before she roll comot from ontop me. She throw the bed sheet over herself, begin sleep again like say nothing happen.

I pick my phone back, look all the messages wey line up. I no reply any of them. I just slide enter the official WhatsApp group chat for my town youth association. Message don full there too. I begin type official message to address everybody.

As the youth leader of my town… I dey like election period well well. Because na that time political parties dey always come meet me with serious money to help them mobilize people to support them.

Dem dey come with big money because my town na one of the biggest for the state, and na our vote dey determine who go win for the state. Money dey that thing, and me I dey deliver well well.

But to get up from bed begin prepare to go campaign ground that morning no hungry me at all, because of the shege my eyes see for the last political party campaign wey I go for the neighboring town. That political rally nearly take my life.

I turn look Toyosi again as she lie on her belle dey sleep. I no even sabi when I smile. Sleek clean body, part of her full breasts spill out from the side of the small tank top. The wrapper she use cover herself from waist down don fold finish.

Her massive nyansh shoot up, huge and round inside the loose wrapper. I see part of her thick thighs… My penis harden within two seconds again. Na Toyosi save my life that day. If not for her I for don die.

As I dey type message for the group chat, my mind drift back to that hot afternoon for that campaign ground. I first begin suspect say the man wey mobilize me and my people come the rally wan play us wayo, when anytime I ask am for our mobilization balance, the man go tell me say he dey come, say make I wait small.

I begin alert some of my boys say this man wan play smart, make dem dey on alert, dey watch am well. Small time… we no see the man again. nobody know when the guy take vanish from the campaign ground. The bastard carry our money run go.

E pain me ehnnn… after all the wahala I do for that man, he still get mind carry our money run go, leave me and all the people I carry go that campaign ground stranded. I tell my people say make we comot dey go house, say we no get business for the rally again since dem don carry our money run.

As we still dey arrange ourselves to begin travel back home to my town… next thing, fight burst for the rally! Another political party send thugs to disrupt the campaign. Bottle begin fly everywhere like rain. Gunshot sound from every corner like say na December knockout wey no get end.

The fight tough. People scatter left and right, screaming, running for their lives. All my people scatter…

I look right, dead body scatter for ground. look left, blood everywhere like red paint wey dem pour. As I dey run one time I hear gbim! for my head, sharp pain shoot through my skull, but I no stop. I just dey run like mad person wey spirit dey pursue. My leg no wait for my head at all.

Na when I enter one person farm very far from the rally space I notice say blood don soak my shirt from my head reach my chest. That gbim wey I hear na person carry 2 by 2 wood knack me for head. I no know wetin happen after that… na the last thing my eye see before everywhere turn black.

The next time I open eye, I see myself inside one small parlor. I look around with speed, my heart beat like drum. I no sabi where I dey. My head heavy like say dem put Zuma rock ontop am, and e dey pain me bad. I remember the blood… As I raise hand touch my head I notice say big white bandage don wrap am tight. Dem don comot my shirt from my body. My chest dey rise and fall fast.

Small time one woman enter the parlor. Old woman, my mama age mate. She begin narrate give me how her daughter see me where I faint inside their farm for the back of their house. She say make I thank God say her daughter see me that time because say I don bleed out, and luckily say her daughter na nurse… if no be for her, I for don die there for their farm.

The woman carry my small bag give me. I open am quickly, check everything… Everything dey intact. My phones, my car key, wallet, ATM, money, everything. I thank the woman, tell her say I wan dey go. She shake head, say make I rest small, say the area no too safe, police dey everywhere dey arrest people wey dem see.

Na then Toyosi enter. My eye freeze for her one second. Dem no even need tell me say she be the woman daughter because two of dem resemble well well. Even as my head dey bang dey pain me severely, I still recognize say this girl fine scatter.

Perfect figure, full breasts wey press against her top, fine round yansh wey heap for her back as she dey waka like say dem construct am for her back.

Toyosi say she check my bag see my ID card and other things, plus the party crested shirt wey I wear. She say na then she know say I no be bad person, because I no follow the party wey dey cause problem.

After Toyosi tell me how she take see me for their farm and how she take confirm say I be innocent person, I bin narrate to Toyosi and her mama the whole story… how the man wey arrange us come for the rally take our money run go, how we don almost leave the venue when the fight start. I tell them say I need go back to check my people.

Mama Toyosi no still gree. She say make I pass the night, say I go continue the following day. But I no gree. I tell her say as the leader I suppose go check on my people, say with my ID card police no go do me anything. Before I comot, me and Toyosi exchange contact. Her mama just dey pray for me as I dey waka comot. I promise dem say I go keep in touch, say I go return their kindness.

By the time I reach where I park my motor around the campaign ground, night don already cover everywhere. Dem don use stick redesign my motor glass… even burst my tire. I just stand dey look my motor like say e be stranger. I see some of my people. Dem say dem don dey find me since. Some don already don find their way go back home. Nobody die from my side, but people wound well well. Blood, bandage, swollen face… everywhere.

Few days later I go that town to fix my car and take am back. I stop for Toyosi dem house. That day na only her mama I meet for house, Toyosi no dey around, e pain me o, because I bin wan see Toyosi again, but then I remember say I get her number, I fit call her anytime. But as me and her mama dey gist the woman tell me say Toyosi dey prepare for marriage!

The talk hit me like say dem take hammer hit my chest. When I dey comot, I give her mama better money take appreciate wetin dem do for me that day, I tell her say make she help me thank her daughter too. The woman hold my hand, bless me well well.

I later use my office as the youth leader deal with that man wey carry our money run that day. I collect every penny wey that man run away with… still collect compensation for people wey wound from the man party. I show dem say I be town youth leader, I no be political party youth leader. Na the people put me for post, no be any political party appoint me.

I snap out of my pensive mood as Toyosi turn for the bed, she open her eye, look me, smile that her charming smile again. Kai… this girl fine die! My heart pause, how I wan take tell her say I wan go another political campaign again? After wetin happen that day, she go just look me say I no serious with my life.

After that incident for Toyosi town I talk say I no go go any other campaign again. But this party representative wey come meet me na very nice man. He pay me pass the money wey I bill them. The man even beg me say he want make I personally work for am.

Who am I to reject national cake offer? Omo… me I accept with open arms. After all, for the end, all man go still vote for who he want to vote for. I don already make up my mind say I go turn up with my people for this campaign.

Written by DND

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 64 times!

Written by
Dr. Deolu Oniranu-Bubble

Premium Stories

Premium Stories

Premium Stories

All Time Favorites

error: Content is protected !!!
Verified by ExactMetrics