
My blood freeze. My head wan explode. Even Usain Bolt no get the kind speed I take fly comot from that bed. My clothes still scatter everywhere for the bed. The only thing I first manage grab and wear na my underpants.
My head just scatter, I no know wetin to do. Piss and shit hold me the same time. Wetin carry my wife come this hotel this early morning? Abi person see me come tell her? choi I bin dey too drunk that night to recognize anybody wey dey the bar.
Abi Sandra set me up? Omo the possibility of that one hit hard, but then, when I look Sandra, she sef dey confused as she dey shove my clothes inside the wardrobe.
I just dey pace from one end of the room to the other like mad man. My wife still dey for the door dey knock. Aswear I never fear like this before for my entire life. Then one idea enter my head, i dash enter inside the restroom to hide.
Sandra drag me comot sharp, whisper say: “No! she might want to use the bathroom!”
Omo my head do gbagaun. No be lie she talk, Nkiru fit say she wan use the restroom, she go catch me inside. Omo everywhere go burst! She go do drama, people go gather with their phones dey record me, the story go begin trend, even enter for some of this gossip blog…. Chai!
I still dey think how my life go scatter when Sandra push me go the back of the big thick curtain. “Stay here and try not to move.” She whisper.
She no even need tell me not to move, dem no born me well make I move. Na for the back of the curtain I dey begin remember all my sweet wedding moments with Nkiruka. Kai… my yeye don finally land me for real trouble.
The curtain long and heavy, e cover me well-well. I no fit see her, but I dey hear every movement. I hear as Sandra comot her perfume, begin spray am fu fu fu fu for the whole room, make she use am dilute my own scent. Bad girl! then I hear when she waka go the toilet, flush am, turn on the shower for small seconds, then finally open the door.
“What took you so long?” Nkiruka voice enter as she step inside the room, my body shake.
Sandra lie smooth say she bin dey ease herself inside toilet.
My wife no even settle finish before she begin cry dey report me give Sandra how I no sleep for house last night, how I take vex comot from house and I no come back. “I’m very worried, Sandra… I just hope I haven’t destroyed my marriage. I just hope he’s fine and has not done something crazy”
My heart drop, na something crazy I do throughout the night, infact na in the middle of the something crazy wey she come interrupt us. But omo I shock o as I dey hear as my wife dey cry dey worry say she don take her hand spoil her marriage.
So this woman love me like this? And she go dey form hard woman everytime. Oboy e sweet me o!
Sandra wey know say I dey hide for background just dey scope her, with soft convincing voice say make she calm down, say if she get back home make she just apologize to me and fix her home. E get when she say “I’m sure he will be feeling better now.” For my mind I laugh, I know say she dey take style pass message give me.
Nkiruka sniff, tell her say she dey ready to fix everything. Say she just want make i come back home.”
If you see the way Sandra dey use pure conviction dey talk say I go soon come home and I go accept her, even me sef if I be Nkiruka I go almost suspect something with the way Sandra just dey very sure say I go hear her.
She even tell my wife say make she take the day off from work, stay for house, cook my favorite meal and wait for me. say if I come make she just fix things.
I just dey for that corner behind the curtain dey hear as the same woman wey I just fuck finish dey advise my wife on how to fix our home. I thank God say na vex I use take leg comot from house that night, because If to say I drive my car comot, naso my wife for first my car for the hotel garage.
Small time Nkiruka stand up say she wan wash her face. Heeiii! If you see as I begin scream hallelujah for my mind. So if to say I bin hide inside that restroom, naso she for catch me naked!
As she enter the bathroom, I bring my head out give Sandra thumbs up. She smile, wave hand sharp make I enter back. Na then I sight my wallet for ground near the corner of the bed. I point am urgently for Sandra make she pick am… as Sandra sight am wan bend down to pick am, the toilet door open. I quickly dive my head back behind the curtain like lightning.
Nkiruka no see me. I dey that place dey pray to everything wey I believe in, I just stiff dey wait to hear Nkiru ask about the wallet. Few seconds pass, I no hear anything, omo heat wan kill me for where I hide. Then the two of them begin talk again.
Nkiruka just dey profess how much she love me, how she no wan lose the marriage. I dey listen, my mouth open. Ehn ehn… so my wife get this kind deep love for me? But Inside the joy I just dey pray make her eyes no drop down see that wallet, because na she buy am for me and she go sabi am immediately if she see am.
Then… silence. Suddenly the whole room just go quiet again. No talk. Nothing. But I know say both of them still dey inside. The next thing I hear one soft sound wey make my whole body shake behind the curtain. At first I doubt am. I tell myself say no be wetin I think. Then the sound come again, this time wetter, louder, longer. Na kiss!
I hold my breath, bring my head out small, I no see well. I lean further, slowly… the next thing I see make my blood turn to ice. I see as Sandra hold the back of Nkiruka head, pull her closer. Nkiruka sef wrap her arms around Sandra.
The two of them bin dey kiss deep and hungry, like say na man and woman dey copulate. Tongues rolling inside their mouths, soft moans, bodies pressing.
Something like bell drop for inside my belle. Anger and pure rage full my body. I just dey boil dey look them. So na wetin Sandra and my wife dey do? No wonder Nkiruka fight me tooth and nail make Sandra stay for the house.
No wonder every time she spend time with this woman, she no even dey reason my matter. Kai… “school daughter” my foot!
I see as Sandra’s hands begin slip Nkiruka clothes comot from her body, slow, deliberate, experienced. The way Sandra use intensity kiss my wife as she dey strip her, e be like say she don even forget say I still dey hide behind this curtain.
And na wetin pain me pass, say my own wife dey make love for my front and I no fit do anything, because me sef no suppose dey there. I just dey vex, heart beating like drum.
I just stand there, frozen, my mind don fly far away, dey look, dey watch as Sandra undress my wife completely naked right for my eyes. I see my wife round, smooth breasts and full body comot clear under the hotel light.
Body wey she no gree give me all these days since I return from travel. Soft, familiar, beautiful, now another woman dey touch am, dey flex am.
Nkiruka sef no just dey receive. She sit up, eyes half-closed, she begin undress Sandra too. She go comot small, kiss small, her lips trail down Sandra neck, hands sliding under the bedsheet, pulling her remaining cloth away.
The way the two of dem bin dey move, you go know say dem don do this thing many times before. Sandra and Nkiruka dey for the big bed, completely naked now. Soft yellow skin against lighter brown skin. Hands everywhere.
One of her hand gently hold Sandra’s face. This time our lips crash wild, hungry, unforgiving. Sandra kiss my wife back with same energy. Deep, like say na normal thing. their bodies press together. Soft breasts smash against soft breasts. My whole body shake violently. Aswear, dey hear say woman and woman dey make out but I never see am happen with my two naked eyes. And now wey I dey see, e come be my wife wey dey involved.
My head scream “Abomination!” As dem dey kiss, their lips lock, tongues dance. Breasts rub together. Sandra pull my wife hair gently, drive her lips go Nkiru neck. The moment her mouth touch my wife neck, I see as Nkiru shake. For my mind I say Shuuu… na woman dey do her fellow woman this kind thing?
Their lips jam again, this time, Nkiru mesmerize Sandra with her lips, her tongue dance inside her mouth like say she dey inspect every part of her mouth. As dem dey kiss like two people wey dey fight for oxygen, Nkiru no gree release Sandra head, she hold am tight, press her mouth harder against Sandra, dey kiss her like say she wan make dem both suffocate. The way Nkiru kiss her ehn… if Nkiru ever kiss me like this, I for don go pay her bride price again to her parents. Sandra just dey kiss her back, her hands rub her head, pull her closer like say she wan swallow her.
Sandra finally pull away small dey gasps like fish wey dem comot from water. Nkiru begin kiss down her neck… then straight to Sandra breasts. The moment her mouth cover her left breast, Sandra whisper “Yessss!” I see as my wife begin dey suck Sandra full, heavy breast like say she wan finish am, tongue flicking and teasing her nipple till e stand like soldier, teeth grazing the tip just enough to send electric shock through her body. Her other hand fondle the second breast, squeezing, pinching.
Aswear e be me like dream, like film….. My legs don already weak for where I stand behind that thick curtain. My head wan explode. Heart dey hammer my chest so hard I fear say dem go hear am. Na my wife dey do all this kind thing!
Woman wey I marry for house as my wife! From Sandra body movement, I suspect say she no dey comfortable with the whole thing because she know say I dey behind the curtain inside the room, but the sweetness no fit make her stop Nkiru.
She just dey there dey hiss like serpent, dey howl low like wolf wey never see food for chop. Her back arch, toes curl.
Sandra grab Nkiru hand drag am straight down to her toto. The moment her fingers touch there, even Nkiru herself pause. She whisper tell Sandra say she don wet like July. Sandra just laugh inside her ear one kind yeye ashawo laugh.
I imagine how her pussy go don already dey drip like tap wey no get control. after all I bin dey pound the same pussy few moments ago.
Nkiru slide one finger slow… slow from the bottom of Sandra slit up to her swollen clit. Then she grip her clit, twerk am gently between her two fingers. Sandra body begin jerk uncontrollably.
That one nearly use load moans throw the room down, dey knack her hand on the bed like craze woman. If dem convert the number of times she take talk fuck to money, e fit buy Bentley. She just dey whisper am “Fuck… fuck… fuck” like say na prayer point.
Nkiru push two fingers inside Sandra, curl them, tickling that sweet spot wey dey drive woman crazy. The pleasure shoot straight to the tip of Sandra nipple. She begin jerk, dey laugh on top bed like person wey don lose one nut for head. My mouth no fit close. My face turn white.
All the fuck wey I fuck Sandra that same night vanish from my head like smoke. The sweetness, the drunken heat, the way I slam her yansh, everything scatter. Only the sight of my own wife naked for another woman’s arms remain.
Small time Sandra suddenly jerk Nkiru roll her like say she no get weight at all, she make my wife lie on her belle. Nkiru quickly raise her hip high up like say na doggy position. My heart skip, Sandra no send me again o, she no care say I dey there dey look.
Wetin this woman wan do my wife. The way both of dem just understand each other position na wetin surprise me pass, how long dem don dey do this thing.
Before I fit think finish, Sandra grab Nkiru nyansh with both firm hands, spread her cheeks wide open, then she bury her whole face in the middle of my wife beautiful ass cheeks. Her tongue dive straight to her toto. She no just use tongue, she take her whole mouth, cover Nkiru dripping pussy, drag one long, deep suck. The sound of Sandra mouth on my wife pussy slap the walls.
My wife whole body vibrate like say current pass through her. Nkiruka scream “Ahhh… Sandra!”
Sandra lift her head small, her lips shiny with my wife juice, eyes dark with hunger. Our eyes jam…… she look me, smile one kind wicked smile…
Written by DND
Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world
This post has already been read 1710 times!