Site icon Welcome to 'Deolu #ONIRANU Bubble! The Largest Collection of Authentic African Stories

Yeyegist: The Woman Wrapper (Chapter 5) [18+]

I first hide from Iyabo for some days dey avoid her, but I notice say she sef no find me, e come be like say na me dey stress myself dey hide from her. Iyabo just dey live normal life like say nothing sup, na me dey one place dey use over thinking wound myself.

I call her one morning; say I go like see her later that day. Iyabo first do small shakara but I whine her well until she agree say she go come. Na as she come my side for evening, I ask her wetin we go do the belle… If you see the way Iyabo take ask me which belle, like say she no know wetin I dey talk about. Na me come dey explain the belle wey she carry give her.

Iyabo say she no get belle o, say she no remember when she tell me say she get belle. Omo I off! Na me com be like mumu. I no need make person tell me wetin she don go do to the belle. E pain me oo, but atleast I happy say my hand no dey the whole plan.

After that day wey me and iyabo talk about the belle we no see again until few days before I go NYSC camp. She just call me one afternoon tell me say she wan come see me, but she no want make my papa see her. That one hard me because my papa no gree comot and that period my babe bin dey around, everywhere just tight for me.

As she see say the meeting no go possible for my house, she arrange say make I meet her for her family house. That move na one of the most risky move I don take for my life because of toto.  Her elder bro wey be one strong cultist for area bin dey eim room for their old family house dey jam music loud. I hear say the boy dey do yahoo and na still one big time cultist. Iyabo sneak me enter the house go her room, say make we fuck.

I no even know say her brother Ariyo dey house, Iyabo no tell me, because she know say if to say she tell me nothing go carry me go their house. She sneak me pass through kitchen enter the main house go her room. As we enter room naso we rush comot cloth like say fire dey our body, i divide her leg well like compass, her toto just shine face dey greet me say long time no see.

We no even do any romance or foreplay I just push my preek enter her pussy. kai I don miss this toto. The speed wey I take begin knack Iyabo me sef fear if my preek no go spoil something for her body because I just dey enter deep, Iyabo wey normally be noise maker this time she use her palms hold her mouth tight as I dey fuck her recklessly.

Small time she lock me with her two legs, for my head I say na here I die, my body begin dey give me signal me say I go soon reach my end and I no fit risk am release inside her but I no fit stop to think anything, I just dey drill her toto dey go. as e reach time wey I wan release I try pull out but Iyabo hold me tight still lock me with her leg come press me gum her body well say make I no worry say she go handle am.

Naso I release the whole thing inside her. Normally fuck no dey tire me, my preek still hard kpa.

For my mind I say if I no fuck Iyabo nyansh my ancestors no go forgive me, I turn her quickly ontop her old bed, Iyabo go on elbows and knees immediately, she give me her full back, still spread her leg as she kneel ontop her bed, Iyabo nyansh still soft like I remember am e be like santana nylon wey dem put water inside.

I first take time grab her ass cheeks squeeze am well, I rub her nyansh use my preek tap her wide nyansh before I slip my hard fat tool enter her wet pussy with one deep thrust, followed by very fast thrusts wey send her straight to another planet. Iyabo nyansh sweet to fuck I no go lie.

Wetin burst me for her na how she dey whine her nyansh as I dey bang her, e get as she dey use her pussy dey collect my preek as I dey thrust inside her. I surprise say we fuck our normal rough sex and she no use shout scatter the whole house as she dey do for my house.

But I notice say e no easy for her as she bin dey try bury her sound but small small stiffled moans still escape from her mouth, thank God say her brother music player bin dey blast music full the whole house. As I dey jam her naso I dey spank her nyansh like old times, she come dey remind me of dirty things wey we dey do then for my house. my head wan burst, at a point I hold the hip firm, concentrate well, begin go 3 strokes per second.

I just wan fuck her for all the weeks wey I no kpansh her. Iyabo forget our condition sotey she no know when she begin scream her normal shout.

The next thing, the music wey bin dey play just stop to play. I come hear her brother voice as eim shout from eim room say who dey the house, omo I nearly faint… if Ariyo catch me here na die for me! I give her that “why didn’t you tell me look” Iyabo no even answer me, she just tiptoe go the door side. I use hand signal to her say make she answer fast before Ariyo go suspect something come enter her room.

She shout back reply say na she dey inside. Her brother ask her say she and who dey shout, she tell am say she dey talk to person on phone, eim no talk again. Small time the music continue to dey jam. naso we sef continue our fuck from where we stop, but this time we do am lowkey.

When I finally go for my NYSC, I follow myself talk serious sense say I go reduce my kpanshing, because too much knack no dey make person get focus for life and e dey slow person success. I make up my mind say no matter the temptation I go control myself. I know say e no go easy but I no know where I see the kind determination wey full my body that time.

Four solid months pass I no gree fuck any toto, I say make I just serve my fatherland in peace. All that time temptation bin dey hit me from every corner. My fellow female corp members no gree me rest because normally I be fine boy and dem know say my pocket gauge well, I even carry one of my mama car travel come for service, as par say big man pikin no suppose suffer.

Every day one female corper dey tell me say she wan follow me go my lodge make she cook noodles chop, “Corper Ade I want to come and know your lodge” me I know say if I carry any of dem go my house, we go definitely fuck, so I just dey avoid dem like plague.

For the school where dem post me, e get two teachers wey bin wan use attention wound me, no be say na me be the only male teacher for the whole school o, but atleast na me be the only single male teacher because the other three male teachers don marry. This two teachers in particular Debby and Jumoke no dey gree me breathe, every time naso dem go just dey hover around me like fly wey dey follow shit.

Debby get big bress, and she dey always wear cloth wey open her bress well, that wan na slay queen wey just dey use teaching cover up her side hustle. She no get nyansh like that, she slim and she fine well well. Small thing Debby don enter my class dey ask me question for her textbook like say na me send her teaching job.

E get the kind eye she dey always cut give me, wey normally me I decode say she want make i knack her.

The other one Jumoke, I dey call that one jummy jummy that one get thick body, I hear say she don even born one pikin but she never marry. She carry bress wey large like handbag, still get big fat nyansh, Jummy no too fine like that for face but I no go lie, her body go well.

Wetin make me like Jummy na because of the way she dey carry herself like say na she borrow the owner of the school money wey dem take build the school. Na Jummy take her hand collect my number, she go just send me her pictures for my whatsapp say make I rate am like say I be fashion police.

Na every morning she dey send me prayer message. I know say both of dem bin want make me and dem run matter, but that period I don lock my preek

E get one time wey our compound bin get water issue, anytime wey I wan fetch water I go need carry gallon go one chief compound down the street to get water, na there I meet Essy. If to say she no tell me say she be housemaid I for take am say she be the owner of the house pikin.

Essy clean die, fine lady, probably around twenty four twenty five years old with narrow waist, full lips and gigantic round buttocks wey dey shake effortlessly. dem fit divide Essy nyansh into four parts make each person still carry large portion.

Her chest full with bress and wetin marvel me na how her bess big still point forward, stand erect upon say e big. Her face fine well, spotless light skinned beauty with pink lips. I come dey wonder how I never sight her since I come that area. Me I just tell myself say e be like say this my celibacy thing go pause.

From the first day I see Essy I begin go that house go fetch water every day, even when I no need water I go pour all the water wey dey my gallon inside gutter empty my gallon so that I go fit get reason to go Essy dem compound to go fetch water. Even Essy sef go know say na because of her I dey come fetch water everytime, because how person go fetch 4 gallon for morning, still come for evening fetch another 4 gallon everyday. Even if I dey take the water swim for house, e no reach to use water like that.

From casual greeting, I and Essy begin talk small small, na then she tell me say she be housemaid, say na the madam carry her come from village come stay with them. But aswear my mind tell me that time say this lady no be like house help at all, but I reason am say maybe her oga dem just sabi how to take care of her because this girl too sharp to be house help. Even the phone wey she dey use sef na better big phone.

I collect her number asap, both of us begin chat well for night, but I make sure say I dey respect myself steady around her. na only one day I talk about relationship she tell me say she no wan talk about relationship, I just change topic asap.

E reach one afternoon I say make I rush go fetch water for Essy dem compound before rain begin fall as the weather don already set for better heavy rain. I try the tap wey dey outside the compound water no rush comot, I begin knock the gate, make I tell Essy say the tap outside no dey work, I don almost give up dey go back to my house as the weather don change and the rain don even start to dey drop small small when Essy open gate come meet me. Essy tie one small towel, e be like say she bin dey baff as her body still dey wet.

The way I first take eye scan her from head to toe, if to say eyes fit comot cloth from person body, my eyes for drag that towel comot from Essy body. I notice the huge lump of flesh wey she reveal for her chest region with the way she tie the towel. The towel short very well and e expose her top thighs. Everything about Essy just dey sexy that afternoon. She tell me say the tap outside the compound get issue say make I come inside the compound come fetch water.

Na the first time I enter that compound, the house big come fine well well, you go know say her oga dem get money. As I follow her for back enter the compound I just dey count as her waist dey roll her nyansh. My penis begin stand. E no dey hard that wan to erect, immediately I sight potential pussy. I begin dey imagine how her bare body go dey inside the towe.

I just dey carried away dey imagine plenty things sotey I no know when Essy point the tap for one corner of the compound for me—I still dey follow her for back wan enter the main house when she turn around point the tap again say na there I go fetch water.

Aswear I don lost finish, she tell me say make I let her know when I finish so that she go fit lock the gate back. as I dey fetch the water my mind just dey do me like say make I go knock the door— knock door do wetin? I say I go knock the door beg her say I wan fuck her. Remain small I burst out laugh. The way her big nyansh bin dey shake under that towel just dey replay for my head.

As soon as I finish, I waka go the main door say make I tell her say I don finish because the rain don already start to dey fall well that time. As I wan knock the door Essy just open am waaam…. the way Essy take open the door be like say she bin know say I wan knock the door, Infact  fit bet am say Essy know say I dey the door.

I shock my eyes nearly roll comot from my eye socket for wetin I see as she open the door. the first thing my eye fall on na Essy big bare breasts with giant nipples wey face me like say e wan attack me. Essy no wear anything from head to toe, she just stand for my front completely naked, dey look me.

Written by D.N.D

If you’re interested in the Oniranu Weekend Brunch, please fill in your location below

Norway/NetherlandsFill Norway/Netherlands Form

CanadaFill Canadian Form

United KingdomFill UK Form

United StatesFill U.S Form

Buy Oniranu Books on Selar.co from anywhere in the world

Download Oniranu Comics here

This post has already been read 8729 times!

Exit mobile version